Beyonce already ft Shatta Wale: Wetin we learn from di music video collabo of di award winning US and Ghana singer

Ghana musician Shatta Wale don thank ogbonge US singer Beyonce afta she release music video of dia collabo ‘Already’ wey also feature Major Lazer.

Di singer post video of di song for im official Twitter account and say ” Thank you My Queen say you believe in my talent and give me di platform to share my good message to di world …God go forever bless you.

Di song na part of her Black is King album, wey dey based on tracks from di Lion King: the Gift, di soundtrack from di 2019 film remake of Lion King.

https://www.youtube.com/watch?v=agCgvFTJeRs&feature=youtu.be

Di release of di video dey come ahead of Black Is King, one feem wey Beyoncé make wey she use songs from The Lion King.

Parkwood Entertainment, wey be Beyoncé’s production company, say dem don dey produce ‘Black Is King’ for di last 12 months.

Di feem go feature skits, songs, and of course, choreography, wey dem shoot for New York, Los Angeles, South Africa, West Africa, Belgium and London.

Wetin di video tell us?

Di video

How pipo dey react to di video

Pipo don enta social media to express themselves.