UK police charge Diezani Alison-Madueke wit bribery

Diezani Alison-Madueke

Getty Images

UK police don same former Opec president and former Nigeria oil minister Diezani Alison-Madueke wit bribery offences.

Police say dem suspect say she collect bribe in exchange for giving multi-million-pound oil and gas contracts.

Alison-Madueke wey dey 63 year, bin be one of di main di main pipo for President Goodluck Ebele Jonathan goment.

She bin serve im minister for petroleum from 2010 to 2015.

She bin also act as president of Organization of Petroleum Exporting Countries (Opec).

“We suspect say Diezani Alison-Madueke abuse her power for Nigeria and say she bin collect financial reward for giving multi-million-pound contracts,” Andy Kelly, Head of National Crime Agency (NCA) International Corruption Unit, tok.

“Dis charges na major achievement for thorough and complicated international investigation.”

NCA say Alison-Madueke chop accuse sake of she benefit from at least 100,000 pounds as cash, correct motor dem wit special drivers, flights inside private jets, luxury holidays for her family, and use of many property dem for London.

Di charges wey dem sama against her bin also give details of financial rewards wey bin include furniture, renovation work and staff for di properties, payment of private school fees and gifts from very very expensive designer shops like Cartier jewellery and Louis Vuitton, NCA tok.

Since she leave office na so she don dey face orishirishi corruption case but she continue to deny di accuse.

British police say now she dey live for St John’s Wood, one big pipo area for west London, and she go show for Westminster Magistrates Court on October 2.

We still dey update di tori