‘No be matter we go like tok about’ – Maersk react to tori of $600 million agreement wit Tinubu

Nigeria Presidency don clear di air on top dia proposed investment from di logistics company, Maersk.

Tori bin comot say di deal wey federal goment bin announce, Maersk neva hear about am.

But for statement wey di Special Assistant to President Bola Tinubu on social media, Dada Olusegun try clear di air on top wetin happun.

E tok say, “many pipo don overlook wetin di first goment press statement bin tok and no check am wit wetin Maersk tok well-well wey cause misinterpretation of both statements… di goment statement no tok say signed agreement dey ground”.

Dis dey come afta tori spread say Maersk no sabi anytin about di statement wey Federal goment put outside say Bola Ahmed Tinubu bin secure $600 million investment from di company.

Oga Olusegun add say, “Di goment statement bin get direct quotes from di Maersk chairman for di meeting wey senior officials from both side bin attend, wia im tok about wetin di investment commitment go do afta dem start to dey implement am”.

E explain say why Maersk bin no tok am openly say na wetin dem dey do wit di Nigerian goment be dis na sake of say dem suppose release dia quarterly financial reports soon.

“Dis period dey reduce di way dem fit tok about ongoing negotiations so dem no go face potential penalties wey dey related to stock manipulation.”

E enta di logistics company say, “To avoid regulatory issues, Maersk suppose advise goment say make dem no publicise wetin dem tok for di meeting gan-gan until dem release dia financial result.”

On Sunday, President Bola Tinubu bin reveal say e secure a $600 million investment from di A.P. Moller-Maersk company.

According to di statement, di investment na to “expand di infrastructure wey dey ground to fit accommodate more shipping containers for Nigeria”

E reveal say dis bin come from meeting wey im bin get wit di Chairman of di company, Robert Maersk Uggla for Saudi Arabia.

E tok say im company don make investment of ova $2 billion for Nigeria ports and oda activities.

E say, “we don see ogbonge opportunity for Nigeria to fit carry bigger ships. Bifor, na smaller ships dem dey take serve most of di West African coasts. Now, we see opportunity to send larger ships come Nigeria. To achieve dis, we gatz expand di port infrastructure especially for Lagos, wia we need bigger hub for logistics.”

Federal goment say di investment go be part of di administration $1 billion investment for seaports reconstruction wey de go on across di eastern and western seaports for di kontri.

Wetin Maersk tok for dia statement?

BBC reach out to Maersk to chook dia mouth on top di mata of di investment proposal.

For statement wey dem send di company say, “A.P. Moller-Maersk (Maersk) don dey work for Nigeria for 35 years.

“As global provider of logistics services, we dey committed to develop opportunities so dat pipo, di port sector and local businesses go fit grow.

“So e dey natural say tok-tok dey ground wit di administration. But we no fit comment on any investment tok-tok.”

Source