Ghana election results: EC Headquarters Presidential Election Ghana results [Elections Ghana] from Electoral Commission of Ghana Headquarters, Accra

Nana Akufo-Addo of di New Patriotic Party don win di 2020 Ghana presidential elections, according to di kontri election office.

Di Ghana Electoral Commission announce Oga Akufo-Addo of di New Patriotic Party (NPP) as di winner, 48 hours after di 7 December election happen.

President Akufo-Addo win wit 51.59% wey represent 6,730,413 votes, according to di head of EC, Jean Mensa

Di main opposition John Mahama of di National Democratic Congress get 6,214,889 votes wey bi 47.36%.

Ghana 2020 Presidential Election Results

BBC

De elections dey hold for more than 38,000 polling stations across de 16 regions of Ghana.

Jean Mensa, de woman wey dey organize dis election don warn say make political parties and media houses avoid to declare any results.

De Chairperson of Ghana Electoral Commission say na only dem get right to announce results according to di law.

Meanwhile polling stations don official close for Ghana election.

Now, attention go leave polling stations and move to de Collations centers for de 16 regions wia dem go announce results.

Meanwhile, Ghana Police arrest di two Electoral Commission officers wey temper with di presidential ballot paper for Awutu Senya West and Bawku central.

Also, Ghana Police Service confirm say two people sustain gunshot wounds for Awutu Senya East.

Ghana president, Nana Akufo-Addo don call for vigilance not violence.

Ghana electoral body say na within 24 hours. Just follow BBCPidgin website and Facebook page to get di result.