Floods in Kenya affect school children resumption date

Foto of school children for Kenya

Getty Images

Di Kenya ministry of education don postpone di reopening of schools across di kontri due to di flooding.

Inside one statement on Monday, Cabinet Secretary of di ministry Ezekiel Machogu say dem go postpone di second term by one week due to di heavy rain, wey don affect some schools in di kontri.

Primary and secondary schools wey suppose open on 29 April go now reopen on Monday, 6 May 2024.

Since di flood start for Kenya for March, ova 70 pipo don die and e don affect ova 40,000 pipo and 100 classrooms for di kontri.

Di East African region don experience flooding due to di heavy rains, and ova 150 pipo don reportedly died for Tanzania while more dan 200,000 pipo don dey affected in neighboring Burundi.

“In di face of di ongoing heavy rains, di Ministry of Education last week don direct im field officers to submit data from all Basic Education Learning Institutions kontri wide to assist di goment in assessing di readiness of di schools for di Second Term opening on Monday, April 29, 2024,” di statement tok.

Di ministry tok say dia data reveal say some school don dey affected for different region while di effect of di rain dey severe across di school communities.

Dem explain say dem dey work with relevant agencies to put water-tight measures across di affected schools and also update pipo.

“Reports received at di Ministry of Education, backed up with data from oda relevant government agencies, show say di number of schools in various regions of di kontri don dey affected by di rain.”

Why di school postponement?

Ova 70 pipo don die of flooding for different part of di kontri.

Education ministry for Kenya explain say data from Basic Education Learning Institutions show say di heavy rain don severely affect some schools for different regions.

Parents bin raise concerns ova di safety of dia children for school as di second term wan reopen across school in Kenya on Monday, 29 April.

Kenyans don dey suffer road blockages for di kontri since di heavy rain fall, na dis make di goment take di decision on school resumption postponement.

Online fotos show di impact of di flood on schools and houses since di tragedy start.

Foto of Kenya president, William Ruto

BBC

Wen di school go reopen?

Schools for Kenya go reopen on 6 May 2024 based on di announcement of di kontri ministry of education on Monday.

“Di Ministry of Education don resolved to postpone di reopening of all primary and secondary schools by one week, to Monday, May 6, 2024,” Ezekiel Machogu, Cabinet Secretary for ministry of education for Kenya tok.

Although, some parents for di kontri dey complain ova di late postponement wen dem don already make travelling arrangements make dia children resume schools today.

While reacting on X, Nairobi govnor, Sakaja Arthur Johnson tok say goment go provide buses for school children and im go return di fare of stranded school children

“Following di postponement of School Opening Dates and di fact say many parents don already release dia children to report to school dis morning, we don organise di payment of return fare for di stranded students,” di govnor tok.

“My teams dey various bus stations sorting out transport for children in uniform as dem dey make dia way back home.”

How bad Kenya flood dey?

Major roads bin dey flooded, e bin dey cause traffic jams across di kontri.

On Saturday, Kenya Airport Authority issue statement to warn travellers about di heavy rain fall wey don affect di runway, terminals and cargo section.

Di airport authority explain say dem go divert flights.

Kenya National Highways Authority issue advisory to motorists say di heavy rain don wash away several houses for Kinale and Kijabe wey don make di roads impassable for motorists.

“Dis areas dey heavily affected, wit road blockages. Currently, traffic dey stand still around Mai Mahiu centre,” di agency tok.

“Authority dey mobilise effort to clear di road and assess damages. Motorists dey advise to expect high traffic congestion around Mai Mahiu. Road users dey expected to plan dia routes accordingly and exercise caution wen travelling through di affected areas.”

Source