Who be Uzoma di new deputy premier and health minister for Canada

Di province of Manitoba for Canada don appoint Nigerian woman, Uzoma Asagwara as deputy premier and health minister.

Asagwara make history wen dem appoint am as di first black woman wey go serve as deputy premier for di province.

Wab Kinew, wey be di premier of Manitoba appoint Asagwara and 14 oda pipo to serve as members of im cabinet on 18 October.

Asagwara na Nigerian-Canadian born citizen to Nigeria immigrant parents.

During di ceremony Asagwara wey wear blue traditional attire, agbada to express appreciation for her root in di Nigeria culture.

Di deputy premier swear her allegiance to King Charles III as she promise to dey faithful and fulfil her duty.

She tok say Manitobans deserve make dem get good representatives for politics.

Asagarawa say di message dey clear to evri Manitiobans as dem get value and everibody deserve respect, if all of dem fit work togeda to lift pipo, dem go get opportunities to achieve beta tins for dia province.

She also tok say “di province diversity na im strength”

Asagwara na also member of Winnipeg LGBTQ community for canada.

Asagarawa political career for Canada

For 2019, Asagwara na di first black pesin wey pipo elect as member of Manitoba Legislature Assembly under di Manitoba New Democratic Party.

She serve unda di 25th Premier of Manitoba and di First Nations Premier in Canada, Wab Kinew.

Before di appointment, Asagwara na psychiatric nurse, addictions specialist and community advocate. She bin dey among basketball player for University of Winnipeg and di Canadian National Basketball team.

On Saturday, Alex Otti di Abia State govnor don congratulate Asagwara wey bin di new health minister and deputy premier of di province of Manitoba, Canada.

Di govnor describe her success story as inspiration to Nigerian youth wey get dream an talent.

“She don show say wit passion, dedication, and perseverance, no goal wey no dey unattainable,” Oga Otti tok.

“She demonstrate our Nigerian heritage na di source of pride and strength, no be limitation. I dey proud of Uzoma Chioma Asagwara.”

Also, Peter Obi di presidential candidate of di Labour Party during di 2023 presidential election don congratulate am ontop im page for (X) formerly Twitter, im tok say achievement show di dedication and resourceful spirit of Nigerians.

Oga Obi tok say Asagwara na di first black pesin to achieve dis position for Manitoba, Canada.

“I congratulate am for achieving dis feat, wey bin say na only hard work, commitment and dedication to duty fit let you earn am,” Oga Obi tok.

“She dey serve as a lesson in hard work to millions of Nigerian youth. I wish am success for di new position and encourage am to dey continue to pursue societal progress both for Canada and our kontri, Nigeria.”

Source