Supreme Court reserve judgement for Atiku, Obi case against Tinubu

Di Supreme Court don reserve judgment for di appeal by Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party (PDP) against di judgment of di presidential election petition court wey affirm di victory of President Bola Tinubu for di presidential election.

Na Justice Inyang Okoro wey be one of di most senior judges for di apex court dey chair di panel.

Remember say for 6 September, tribunal bin reject Atiku and Obi cases against Tinubu election victory.

All di five justices wey dey for di panel rule say di opposition candidates fail to prove say di election bin get K- leg.

Dem say PDP and LP fail to prove dia case of over-voting and voter suppression, dem add say two of dem no provide correct evidence to support dia case for court.

Di seven-member panel for di court, wey Justice Inyang Okoro lead announce am on Monday afta Lawyers to di parties bin adopt dia briefs of argument and make final submissions.

Di High court bin also consider arguments from lawyers to parties on di motion wey Atiku file say make dem supply fresh evidence on forged documents.

Counsel to Atiku Abubakar, oga Chris Uche, bin beg di court to grant di motion and allow dia appeal grant dia prayers, and make dem disqualify Tinubu.

All di counsel to di respondents, Abubakar Mahmoud for di Independent National Electoral Commission (Inec), Wole Olanipekun for President Tinubu, and Akin Olujinmi for di All Progressives Congress (APC) bin urge di court to dismiss di two motions and appeal sake of say e dey lack merit.

Wen di court come togeda again, na di appeal of di Allied Peoples Movement (APM) dem touch.

Dem urge di party make dem withdraw dia appeal as e no get prayers for determination.

Counsel for di APM, Machukwu Umeh, bin quickly withdraw im appeal and di respondents no object to di withdrawal. Di court den dismiss di appeal.

Wetin Atiku and Obi want from Supreme Court?

Di candidate of di PDP Atiku Abubakar dey ask di Supreme Court to cancel di judgement of di election petition court.

Di former Vice President don also apply to di Supreme Court to file fresh evidence wey dem get from di Chicago State University against di president.

Atiku don continue to insist say Tinubu academic records get k-leg and dey ask Supreme Court to comot am from office.

Im and im party tok say di court judgement get “plenty mistake and e no dey fair” sake of di way di judges reason di mata to confam Oga Tinubu as president.

Oga Atiku through im lawyer also fault di court on how dem “judge di mata”. Im tok say di judgement “show bias”.

Im say im refuse to accept di judgement of di presidential election petition court wey affirm Bola Tinubu victory for di 2023 election.

During im tok-tok wit tori pipo on 7 September, Atiku say make im supporters calm down sake of say na battle dem lose, but dem neva lose di war.

For im appeal, Atiku tok say di tribunal judgement na error and miscarriage of justice.

Atiku dey ask di Supreme Court to declare say Tinubu no secure majority of lawful votes cast during di presidential election on February 25, 2023.

Di PDP presidential candidate dey ask di court to declare say Tinubu no dey qualified to contest for president wen im contest sake of im conviction for US for alleged drugs trafficking.

Peter Obi, di Labour Party presidential candidate say di election tribunal overlook di facts for im case.

E say dem fail to consider di kain evidence dem bring. Obi and im party claim say di court reach di wrong conclusion.

Dia lawyers on Tuesday file appeal on several grounds, including say make Supreme Court cancel di judgement of di lower court wey confam Oga Tinubu victory.

Dem add for dia case for Supreme Court say Tinubu no bin dey qualified to contest as Nigeria President as at di time wey im do, sake of im conviction for US for alleged drug trafficking.

Justice Inyang Okoro biography

Na 15 November 2013 dem elevate Justice Okoro to di Supreme Court.

Dem born Justice John Inyang Okoro on 11 July, 1959 for Nung Ukim, Ikono Local Government Area of Akwa Ibom State.

Im attend Methodist School, Nung Ukim from 1965 to 1972, Boys High School, Oron from 1973 to 1977, School of Arts and Science, Uyo 1979 to1981 and di University of Lagos from 1981 to 1984.

Im also attend di Nigerian Law School, Lagos wia dem call am to di Nigerian Bar for 1985.

Justice Okoro bin start im legal career as Magistrate Grade 11 for 1986 and rise to reach di Magisterial Cadre wey make am get promotion to di post of Chief Magistrate Grade 1 for 1996.

Dem come appoint am as Judge of di High Court of Akwa Ibom State from 1998 to 2006. Dem later elevate am to di Court of Appeal for 2006 wia im serve for di capacity reach 2013.

His Lordship don serve for different capacities and bodies over di years.

For 1998, im become member of di election petition tribunal for Kano; for 2003, im join as member of di governorship and legislative houses election petition tribunal for Ondo State, later for 2003, im be member of di Governorship and Legislative Houses Election Petition Tribunal No 2 for Delta State.

Im don also attend several seminars, workshops and conferences both locally and internationally.

Source