Kidnap of students for Kogi University – how e happun

Some gunmen attack di Confluence University of Science and Technology for Kogi State, North-Central Nigeria, and kidnap about nine students, according to di State goment.

Dis attack happen on Thursday night as di students dey class dey study for dia exams wey suppose start on Monday, May 13.

A statement wey di State information commissioner, Kingsley Fanwo forward to di BBC tok say “Governor Ahmed Usman Ododo bin immediately activate di security architecture to track di kidnappers and ensure say di abducted students dey rescued and di abductors apprehended”.

Fanwo add say hundreds of local hunters wey know di area well and oda security agents dey comb di areas now to rescue di kidnapped students.

Di state goment say na early intervention of security operatives bin prevent di attackers from having “a field day”, however “di state goment no go spare anything in ensuring dat di students dey rescued and reunited wit dia families”.

Di toktok pesin for di Kogi State Police Command, William Ovye Aya, no pick im calls wen BBC Pidgin reach out to am for details of dis incident.

Im no also respond to messages wey we send am.

Di Punch newspaper tok say di Vice Chancellor of di University, Prof Abdulraman Asipita, confam di incident but im no give details. E rather tok say “we dey on top of di matter”.

Mass kidnappings for schools, whether secondary or tertiary don dey become regular tin for Nigeria.

In September 2023, gunmen bin kidnap about 23 students from di Federal University Gusau in Zamfara State, for North-West Nigeria. Na for April dis year di Nigeria military rescue dem.

More recently, on March 7, 2024, ova 130 students bin dey kidnapped from dia school in Kuriga area of Kaduna State, also in North-West Nigeria.

Di kidnappers later release dem after two weeks in captivity.

Source