‘Dem bin plan to kpai President Zelensky as inauguration gift to Vladimir Putin’

Ukrainian security service (SBU) say dem don scata one Russian plan to kpai President Volodymyr Zelensky and oda high-ranking Ukrainian officials.

Dem don arrest two colonels for di Ukrainian government protection unit ontop di mata.

Di SBU tok say dem dey part of one network of agents wey belong to di Russian state security service (FSB).

According to reports, dem bin dey find “executors” among Oga Zelensky bodyguards wey ready to kidnap and kill am.

Oda targets include military intelligence head Kyrylo Budanov and SBU chief Vasyl Malyuk, di agency add.

Report say di group bin plan to kill Oga Budanov before Orthodox Easter dis year, 5 May.

Di assassination of President Zelensky suppose be inauguration gift for Russia president Vladmir Putin fifth term as presido

According to di SBU, di plotters bin plan to use insider get information about im location, den dem for use rockets and drones attack am.

One of di officers wey dem later arrest bin don already buy drones and anti-personnel mines, SBU tok.

SBU boss Vasyl Malyuk, tok say di attack suppose be “gift to Oga Putin before di inauguration” – dem swear in Russia Vladimir Putin for a fifth term as president for di Kremlin on Tuesday.

Di operation bin turn into failure for di Russian special services, Oga Malyuk tok.

“But make we no forget say – di enemy strong and e get experience, we no fit underate am,” e add.

Dem hold di two Ukrainian officials on suspicion of treason and say dem dey prepare terrorist act.

Di SBU tok say na three FSB employees dey oversee di organisation and di attack.

One of dem wey im name na Dmytro Perlin, bin don dey recruit “moles” since before Russia full-scale invasion of Ukraine for February 2022.

Anoda FSB employee, Oleksiy Kornev, bin reportedly hold “conspiratorial” meetings “for neighbouring European states” before di invasion.

For one released interrogation wit one of di suspects, dem fit hear as e dey describe how dem dey pay dem thousands of dollars directly by parcels or indirectly through dia relatives. E no clear weda e bin dey tok under pressure or not.

Investigators insist say dem monitor di men throughout. We no sure how close dem come to carrying out dia alleged plan.

Di plot fit be like feem but na also reminder of di risks wey Ukraine wartime leader dey face.

Russian forces reportedly bin don dey try to kill Oga Zelensky since di war start.

For April, dem arrest one Polish man on top accuse say e dey plan to cooperate wit Russian intelligence services to help in di assassination of Oga Zelensky.

For weekend, Ukraine president bin appear on Russian interior ministry wanted list on unspecified charges.

Di foreign ministry for Kyiv bin condemn di move say e show, “di desperation of di Russian state machine and propaganda”, and point say di International Criminal Court don issue warrant for Vladimir Putin arrest.

Source