End Sars protest in Benin: Obaseki declare 24-hour curfew, ‘prison break’ reports and violence flood social media – See wetin to know

Edo state Government don declare 24-hour curfew for di state till further notice.

Di curfew go take effect from 4:00pm on Monday October 19, 2020.

Dis one dey come as reports full ground of violence for di state afta ‘hoodlums’ hijack di End Sars protest.

Di govnor say di decision become necessary in di face of disturbing incidents of vandalism and attacks on private individuals and institutions by hoodlums wey disguise as End Sars protesters.

‘Hoodlums’ hijack End Sars protest

Tok-tok pesin of police for Edo state Chidi Nwabuzor tell BBC Pidgin say no be di ‘peaceful’ protesters wey start di End Sars waka dey dia now.

According to am, hoodlums hijack di mata block all di road and even imsef and oda police officers no see road to comot.

One local journalist Timothy Ojon bin tell BBC say no vehicular movement dey as at Monday morning. E say hoodlums don hijack di End Sars protest for di city.

“Dem dey collect your bags, money, since Friday evening.

E dey happun for all over Benin But Ring Road na dia e full, dem dey burn tyres dey cook for street, pipo dey get injured.” Ojon tok.

Prison break for Benin?

Speaker of di house of assembly for Edo state Marcus Onobun bin tell BBC say ‘hoodlums’ try to break enta prison for Sapele road for Benin, Edo state, Nigeria on Monday.

Oga Onobun dey speak as tori dey fly upandan say hoodlums break into prison and free prisoners for Benin.

https://www.facebook.com/watch/?v=372157440638690

“I no dey di state right now, but I dey get reports of violent protest, bonfires and blockage of vehicular movements across di state. We dey try to get across to pipo to know wetin dey happun”

“We don see fotos of pipo dey climb di walls of di prison yard, I speak with some of di officials and dem say dem no succeed, dem say dem make attempt to break into prison for Sapele road and pipo bin dey move towards di Oko prison as well, dat na di report we don get so far.

Di speaker add say dem dey reach across di authorities to find out exactly wetin dey happun and dem no fit make categorical statement till dem confam.

Oda pipo don enta social media to chook mouth inside wetin dey happun.

Reports say di hoodlums don dey worry since Friday.

On Friday, at least one pesin die afta jaguda pipo attack protesters foor Ring Road, di heart of Benin City wia di End Sars protesters gada dey do di protest.

Di jaguda boys attack dem wit machetes, injure many of dem.

Edo State Governor, Godwin Obaseki never tok about dis latest development, but last week, e condemn di attack dat time come ask Police to do thorough investigation into wetin happen and bring di pipo responsible to justice.

“I extend my condolences to victims of di attacks including di ones wey lose dia lives and di ones wey di thugs injure.

E dey very sad say any pesin fit attack a peaceful assembly of pipo wey dey express genuine concerns over police brutality and intimidation for dia own kontri.

I call on di Police Command for di State to go out for di street to provide adequate security for di protesters and make sure say nobody dey harassed as dem dey exercise dia rights for Edo State.” Di Governor bin add.