American International School refund $760,000 alleged advanced school fees from former Kogi Governor to EFCC

Di Economic and financial crimes commission (EFCC) tok say di American international school of Abuja don transfer $760,910.84 to dia account.

Di money na part of di $845,852 wey di former govnor of Kogi state, Yahaya Bello allegedly pay to di American school as school fees of five of im children for di school.

Tok-tok pesin to di EFCC, Wale Oyewale tell BBC News Pidgin say di school bin write to di commission say dem go rather send di money to goment account as di issue don become public matter.

E say EFCC bin send di recovery account to di school and dem refund di money.

“Na di school bin write to us say dem go rather refund di moni to goment account.. and we send di account to di school and di school return di money.” Oga Oyewole tok.

EFCC, on Thursday I8 April bin declare former governor Yahaya Adoza Bello wanted.

Di declaration na sake of connect wit one alleged money laundering issue against di former govnor, di financial crimes join-bodi bin tok.

Meanwhile one Kogi state High Court Judge Jamil don order make EFCC Chairman Ola Olukoyede show face for court May 13, 2024.

Dis na based motion ex-parte wey Yahaya Bello file through im lawyer, M.S. Yusuf.

E bin pray di court for order to issue and serve di respondent, Ola Olukoyede wit form 49 notice to show cause why dem no suppose make order of committal on di EFCC oga.

Di Nigeria Immigration Service bin also issue one alert against di former govnor of Kogi state, Yahaya Bello, as dem urge law enforcement agents to arrest am anywia dem see am.

Also di Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, also tell oga Yahaya Bello to surrender imself.

Di NIS circular wey Assistant Comptroller of Immigration, DS Umar sign, bin copy di Department of State Services (DSS) and di Nigeria Police Force.

Meanwhile, EFCC tok say dem neva disobey court order for di case against Yahaya Bello.

Yahaya Bello charges and why EFCC declare am wanted

On Tuesday 23 April EFCC bin serve former Kogi State govnor, Yahaya Adoza Bello im charges through im counsel, Abdulwahab Muhammad (SAN)

Afta Justice Emeka Nwite wey siddon for di Federal High Court, Maitama, Abuja bin rule say make dem serve di defendant through im counsel, especially as e bin no gree appear bifor di court, yet again.

Na di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC dey prosecute, di commission tok.

Yahaya Bello alongside Ali Bello, Dauda Suleiman and Abdulsalam Hudu dey ansa kwesion on 19-count of moni laundering wey reach moni of N80, 246, 470,089.88k.

Early mor-mor Wednesday 17 April, EFCC operatives bin lay siege for di residence of Yahaya Bello so dem go fit arrest am.

Although oga Bello bin don obtain one court order to stop di action, till dem go determine di originating motion.

One scheduled court session for di arraignment of Yahaya Bello bin go ahead on Thursday, April 18, but e no show for court.

Afta dis, EFCC para come tok say dem go use every legal means, to bring am to court on di next adjourned date to ansa case of corruption wey dem dey accuse am of.

Na afta dis dem declare am wanted.

Yahaya Bello no gree honour EFCC Invitation for Interrogation- Olukoyede

On 23 April di Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, Ola Olukoyede bin yarn tori pipo of how e bin make personal efforts to invite Yahaya Adoza Bello to ansa kwesions to investigations about im alleged involvement for di moni laundering of N80,246,470,089.88 mata.

Olukoyede bin tok how e bin tok for phone wit Yahaya Bello to offer am ample opportunities to present imself for tok-tok by investigators of di EFCC.

“On my honour, I bin put call to am to honour am as former govnor. E bin tok say, I no fit come, claim say e get one lady wey don surround di EFCC wit over 100 Journalists to embarrass or intimidate am and all dat stuff. I tok say if dat na your fear, I go make you come directly to my floor. I go invite my operatives to interrogate you for my own office. Wetin fit dey more honourable dan dat? You know wetin e bin tok? ‘ Shey dey no fit come my village?’ My Director of Investigations bin also send message to am”, e tok.

Di EFCC oga tok say im dey worry about report of how di former govnor go take wetin belong to odas wey dey available to EFCC

“One sitting govor, sake of say e sabi say e dey go, e bin move moni directly from di gment account to one bureau de change to pay im children school fees in advance.

Moni of $720, 000 for anticipation say e go leave goment house”, olukoyede add.

Oga Olukoyede also tok say EFCC, for effort to make sure say di foreign exchange market dey safe and stable, dem don uncover one new fraudulent scheme wey dem dey P to P, peer to peer trading scheme.

E say di platform de operate outside di official banking and financial corridors ,wit more dan 300( three hundred) accounts wey link to am already frozen by di EFCC.

E say di commission commit gidigba for economic growth and development of di kontri.

Olukoyede promise say di EFCC no go do U-turn for di exercise of dia mandate.

E say di Commission don recover more dan N120billion from fraudsters within six months and secured more dan 1300 convictions.

Who be Yahaya Bello

Yahaya Bello na one of di youngest aspirant for di 2023 presidential race at 46 years old.

Dem born am on 18th June 1975 for Agasa, Okene Local Government Area of di state.

Bello bin serve as govnor of Kogi state, for North Central region of Nigeria from 2016 to 2024.

E bin attend Government Secondary School Suleja for Niger State wia e obtain im Senior School Certificate Examination for 1994.

From dia e attend Ahmadu Bello University Zaria to study Accounting wia e graduate for 1999. E go back to Ahmadu Bello University, Zaria to obtain a Master’s degree in Business Administration in 2004.

Im be di fourth democratically elected govnor of Kogi State.

For April

Source