Ova 100 inmates escape prison afta heavy rainfall scata Nigerian prison

One hundred and eighteen inmates wey dey Medium Security Custodial Centres for Suleja, Niger state don escape from prison.

Dem escape on Wednesday night afta one heavy rain wey destroy some parts of di prison buildings including di perimeter fence, wey allow di prisoners escape.

Tok-tok pesin for di Federal Capital Territory Command of di Nigerian Correctional Service, Adamu Duza confam dis prison break on Thursday inside statement.

E say security agents don capture 10 of di inmates wey escape and don take dem back into custody, and dem dey in hot pursuit to capture di remaining ones.

“One heavy downpour wey last for several hours on di night of Wednesday, April 24, 2024, don wreak havoc on di Medium Security Custodial Centres, Suleja, Niger state, plus surrounding buildings, e destroy parts of di custodial facility, including di perimeter fence, wey give way to di escape of 118 inmates for di facility.” Di statement tok.

Di statement no give details on di identities of di prisoners wey escape from di centre but in di past, court don sentence members of Boko Haram Islamist insurgent group go Suleja prison.

But di statement say di service dey work wit oda security agencies and dem don activate dia recapture mechanism to bring back all di escapee.

Di NCOS tok say di reason why di heavy rainfall scata some parts of di prison na because di facilities don old and dem dey weak. Dem build many of di facilities during di colonial era, seventy to eighty years ago, Oga Duza tok.

“Di service dey mindful of di fact say dem build many of dia facilities during di colonial era and dem don old and dey weak. Di service dey make effort to ensure say all aging facilities give way to modern ones.”

Dis no be di first time prisoners go japa from prisons anytime di opportunity show.

E don happun for years sake of attacks and jail breaks and e don become major security concern for Nigeria wia over-crowding, underfunding and little security don male am possible for prisoners to escape.

Thousands of inmates don escape in resent years sake of weak infrastructures and militants attacks.

For 5 July, 2022 Kuje prison suffer gunmen attack inside Nigeria capital Abuja and set 440 inmates free.

Also for 2 Sunday, September, 2021 unknown gunmen bin attack di Medium Security Custodial Centre, Kabba for Kogi State for Northern Nigeria .

Tori be sey di heavily armed attackers wey plenty well-well bin engage di armed guards for serious gun battle.

For April 2021, gunmen attack di Owerri prison for Imo State and set fire to di facility and property inside di compound.

Dis one cause most of di 1,800 plus inmates wey dem keep dia, to escape.

Di police later accuse di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) say na dem dey behind di attack.

Source