Ebila of Ibadan: How di suspected gang leader of ‘one million boys’ take die for Oyo

Suspected gang leader of One Million Boys, Biola Ebila don die.

Di Oyo state police command confam di death of di leader of di jaguda gang to BBC.

Police tell BBC say na members of one suspected cult rival group kill am for Kudeti area of Ibadan, Oyo state South West Nigeria on Sunday.

Residents of Olomi area for Ibadan where dem kill Ekungbemi dey fear on to another fight fit revenge as rival cult groups fit wan revenge.

How Ebila die?

Police tok-tok pesin for Oyo state Olugbenga Fadeyi tok say dem still dey investigate how Ebila take die.

But im explain say di area DPO tok say na “Keke Marwa” tricycle bike na im members of one jaguda group take carry am go where im oda members dey.

He say suddenly na im dem carri im deadi body go Kudeti begin cause trouble for di town but e say tinz don settle now as police dey ground and everywhere don dey calm now.

Oga Fadeyi say before now dem bin tighten security for Ibadan because of di trouble wey dis One Million Boys dey cause for town and dem don dey find Abiola tey-tey afta e chop accuse say e get hand for di death of one Ogungbemi.

He say dem still dey get details of wetin happun and go brief tori pipo later.