Who be US rapper Fatman Scoop wey die at di age of 53

Rapper, Fatman Scoop bin perform during halftime for di LA Clippers and Cleveland Cavaliers game on January 14, 2020 for Staples Center in Los Angeles, California.

Getty Images
Fatman Scoop

US rapper Fatman Scoop don die at di age of Fifty-three. Im representative tell BBC say im die afta im collapse for one concert on Friday for Connecticut.

Im bin dey halfway thru im set for di Town Center Park for di city of Hamden wen im collapse on stage.

Mayor Lauren Garrett tok for one post to Facebook say dem bin carry di rapper go one local hospital wit ambulance.

But im booking agency, MN2S, confam im death for statement to di BBC, wia dem tok say di “legacy” of di New York native “legacy go live on thru im timeless music”.

“Scoop na pesin wey pipo love for di music world, countless fans across di world love im work too” na wetin one agency tok-tok pesin tok.

“Im iconic voice, infectious energy, and great personality make im mark dey special for di industry.”

Scoop bin get credit as an influential figure for New York City’ hip hop scene in di 1990s.

Im don feature on popular songs like Grammy award-winning Lose Control by Missy Elliott and It’s Like That by Mariah Carey.

Dem also know Scoop for im sleeper hit Be Faithful, wey dem bin originally release in 1999 .

But na afta dem release am again for 2003 im get international success afta e top di charts for Ireland and di UK.

For 2004, di rapper bin feature for di UK TV series Chancers on Channel 4, wey bin feature musicians wey dey mentor aspiring UK artists wey bin wan achieve success for di US.

Fatman Scoop also be one of di contestant on Celebrity Big Brother 16: UK vs USA, wey bin happun for di UK and dem air am for 2015. Dat time, im be di third housemate wey dem evict (remove from di house)..

Im tour manager, DJ Pure Cold, write for one post on Instagram say im dey “lost for words” as im hear di news of im friend death.

“You bin carry me go all over di world and make me perform wit you on some of di biggest and greatest stages on dis planet,” im write.

“Di tins wey you bin teach me don truly make me di man wey I be today.”

Fatman Scoop bin don dey set to perform for di UK Reminisce Festival on 7 September.

For one post on Instagram, festival describe di news of im death as “devastating”.

“Im no be just one of our most popular performers, im also be one of di ogbonge members of di Reminisce family,” di festival tok.

“We go miss im energy, talent and infectious spirit more dan words fit express.”

Source