President Emmanuel Macron don appoint Michel Barnier as France new Prime Minister

Michel Barnier, France new prime minister

Reuters

French President Emmanuel Macron don name Michel Barnier as prime minister.

Dis announcement dey come almost two months afta France elections end for political deadlock.

Oga Barnier wey be 73-year-old na di European Union former chief Brexit negotiator and e bin lead toks wit di UK government between 2016 and 2019.

E be veteran of di right-wing Republicans (LR) party, e bin get long political career and e bin don fill various senior posts, both for France and within di EU.

Now e go gatz form goment wey go need to survive National Assembly wey dey divided into three big political blocs, and none of dem don fit form clear majority.

Three years ago, Oga Mr Barnier bin tok say im wan take ova President Macron for di French presidency, e say im wan limit and take control of immigration.

E later fail as im party no select am as candidate.

Oga Barnier go be France oldest prime minister since di Fifth Republic start for 1958.

E go take ova from Gabriel Attal, France youngest ever prime minister, wey President Macron bin first appoint as prime minister for early 2024 and who bin dey di position of caretaker since July.

E bin take President Macron 60 days to make up im mind on choosing a prime minister, afta e call for “political peace” during di Paris Olympics.

In di past few days, e bin interview plenty potential candidates for di job, but his task bin dey complicated as e gatz come up wit a name wey no go lose vote of confidence on dia first appearance for di National Assembly.

Di Elysée Palace say Oga Barnier appointment dey come afta one extraordinary period of consultation, plus Oga Macron don ensure say di prime minister and future goment go offer di greatest possible stability plus di broadest possible unity.

e give Oga Barnier di work of forming a unifying goment “in di service of di kontri and di French pipo”, di presidency tok.

Oga Macron choice of prime minister don already cause wahala within di left-wing New Popular Front (NFP), wey win di most seats for di July sharp election.

Jean-Luc Mélenchon, wey be di leader of di radical France Unbowed (LFI) – di biggest of di four parties wey make up NFP, bin react angrily.

Dem “tiff di election from di French pipo”, e claim.

Instead of coming from di alliance wey come first on 7 July, complain say di prime minister suppose be “member of a party wey come last for di elections.”

“Dis now na Macron-Le Pen goment,” e tok, as e dey refer to di leader of di far-right National Rally.

Oga Mélenchon come ask pipo to join one left-wing protest against Mr Macron decision planned for Saturday.

Jordan Bardella, di young president of di RN for im reaction on X tok say im party prime demand na make dem respect 11 million RN voters.

E make am clear say dem go judge Oga Barnier by im words, im actions and im decisions on France next budget, wey go dey before parliament by 1 October.

E cite di cost of living, security and immigration as major emergencies for di French pipo, and add say “we hold all means of political action in reserve if dis no be di case in di coming weeks”.

Jordan Bardella, president of National Rally (Rassemblement National), left, and Marine Le Pen, leader of National Rally

Getty Images
Jordan Bardella and Marine Le Pen no go take part for Barnier goment but dem go wait and see wetin e dey do

Marine Le Pen bin make am clear say her party no go be part of Barnier goment, however she say e don at least appear to meet National Rally initial requirement, as pesin wey “respect different political forces”.

E no dey sure say Oga Barnier go attract support from di president centrist Ensemble alliance. Macron ally Yaël Braun-Pivet, wey be president of di National Assembly, don congratulate di nominee and say MPs now gatz play dia full part: “Our mandate compulsory us to.”

Na late on Wednesday 4 September, di former Brexit negotiator bin emerge as potential candidate for di role of di PM.

Until then, dem bin parade two oda experienced politicians as di most likely candidates: former Socialist prime minister Bernard Cazeneuve and Republicans regional leader Xavier Bertrand.

But e soon clear say none of dem for survive a vote of confidence.

Dat na Mr Macron explanation for rejecting di left-wing candidate, Lucie Castets, one senior civil servant for Paris wey e tok say for no fit make am.

Source