One year afta Mohbad die – wetin don happun so far as di ‘Light’ neva go rest

A fan showing mohbad name

BBC

Wit tears, sadness and surprise, Nigerians bin receive di news of di death of ogbonge music artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad wey mysteriously kpai for 12 September 2023.

Plenti Nigerians especially di entertainment pipo dey shocked to hear di news of MohBad death sake of di love wey dem get for am and na part of wetin dey raise questions of wetin really happun to am.

Dis na one year already afta Mohbad die and e neva straight or clear wetin kill am or who dey involved for wetin happun to am.

Mohbad na one of di rising musicians for Nigeria bifor e die as several of im songs don go viral wey be say na confam street jam wey pipo dey dance to.

As rising artiste den, Mohbad bin sign under Naira Marley “Marlian Records” but e comot di label for 2022 sake of some controversies.

As plenti pipo sabi, di singer bin marry a Nigerian woman simply identified as Wunmi and dem get one son togeda wey im name na Liam.

Make e no be like say you miss road, make we remind you say late Mohbad bin kpai two days afta e attend one event for Ikorodu Town Hall on Sunday night 10 September 2023.

Wetin kpai Imole? Who kpai Imolenization? Why dem kpai Mohbad? Dis na di question many people still dey ask afta one year.

Mohbad and im record label

As di death of Mohbad shake di kontri and touch many Nigerians, plenti pipo dey call for justice following reports wey allege say e suffer bullying, harassment and assault as a musician wey bin dey signed under im former music label.

Di record label owner, wey also be popular musician Naira Marley bin deny di accuse say e get hand for di death of Mohbad.

Authorities begin investigate di circumstances leading to im death and also di claims of bullying and harassment.

For now, afta one year, e neva get any traces of wetin lead to di death of Mohbad.

Di Lagos State coroner inquest open since 2023 to find out wetin really kill Mohbad and dose wey dey involved for di mata, but up till now, di coroner neva finish dia investigation.

All dis na sake of di tori say Mohbad attend one event for 10 September 2023 wia e get kasala wit im friend wey lead to small injury for im hand wen e bin wan throw blow.

Na di small injury dem bin treat from one hospital to di oda till e die.

Between Mohbad papa and wife

Wen BBC News Pidgin bin follow Mohbad papa tok for October 2024, e tok di kain pesin wey im pikin be wen e dey alive.

“Mohbad na veri quiet pesin, e no dey tok, whatever you give am dey satisfy am. E be my friend, we dey veri close like brothers.”

Mr Joseph Aloba dey veri pained about di death of im son, and e dey suspect say some kain pipo dey behind how im pikin die, according to di testimony e give for di coroner inquest.

“E bin dey follow me for my musician work, sometimes e go dance, sometimes e go back me up, na so we start,” e tok.

For di interview, Mohbad papa mention say e gatz know if im grandchild na from Mohbad true true or no be so – wey make am tok DNA for Mohbad wife.

Anoda serious gbege wey happun na how di papa of Mohbad dey ask say make dem do DNA test for di pikin wey late Mohbad leave behind.

But contrary to di tori say di court don request make Wunmi appear for di DNA test, di lawyer Taiwo Olawanle wey dey represent Wunmi for court tok say dem neva serve her any notice.

Dat mata too still dey ground.

For November 2023, di wife of di late singer give her testimony for di coroner inquest for Lagos wey dey chook eye inside how her husband bin die.

She tok say her husband bin vomit for toilet afta nurse shook am injection.

As tears dey roll, Wunmi Aloba wey be di wife of di deceased appear for court to reveal say her husband begin dey complain afta di nurse give am injection for inside di room and im go toilet go vomit.

Wen pipo begin dey shook mouth, Wunmi wey tok say na for ova ten years she don sabi her husband and e don dey do well bifor e go sign for record label.

“One day im tok me say Naira Marley message am for Instagram say make dem link up. I advice am say make e just feature Naira Marley for one song, make e neva sign any deal but Mohbad say di signing go help im career.”

During di coroner investigation, Wunmi clear di rumour about her and Naira Marley.

She say she bin no sabi Naira Marley from anywia until Mohbad begin dey tok about am and e dey trend dat time but tins begin dey fall apart wen dem no gree make im change im manager.

She even tok say her husband leave Naira Marley record label wit zero account and e struggle to survive even as some artistes begin dey avoid am dat time.

Wetin Mohbad DJ and broda tok?

Meanwhile, di personal Disc Jokey (DJ) to late Mohbad, Ajisegiri Sultan Ayobami also narrate for di coroner inquest how di late singer bin vomit bifor e die.

Di DJ na one of dose wey witness evritin wey happun to Mohbad bifor im die. E dey always follow late Mohbad as part of di music team.

According to DJ Bami, Mohbad dey fine wen dem reach house afta di show aside say dem bin dey treat di cut wey dey im hand as dem use cotton wool clean di wound wey dey back of im right hand.

DJ Bami tell di court say Mohbad bin chop noodles wey im broda cook wen hunger catch am di next day but e later vomit am and na den dem kon call nurse.

Who be dose wey chop accuse ontop di death?

Na several pipo dem don put hand for dia eyes say dem bin dey related to tins wey happun to Mohbad bifor e die.

For 4 October 2023, di Lagos State Police Command bin declare Owodunni Oluwatosin alias Primeboy wanted but few days later, e go show imsef for police station.

Bifor, di authorities bin declare Primeboy wanted afta e fail to honour police invitation wen dem begin investigation into di death of Mohbad.

Primeboy na di Mohbad childhood friend wey e get fight wit on 10 September 2023 for di last show wey e go perform for Ikorodu.

Wait small…

No forget say police tok dat time say dem identify and interrogate a total of 26 important witnesses plus di pesin wey carry di complain go meet authorities.

Di pipo wey dem interrogate and investigate include Mohbad papa, Mohbad mama, im sister and broda, im wife, im manager, im personal assistant, im DJ, photographers, im friends, di driver wey Mohbad hire im Prado Jeep to attend concert for Ikorodu and odas.

As e no stop dia, e also get some allegations of bullying by Naira Marley and Sam Larry.

For October 2023, police say dia investigations show say true-true Naira Marley and Sam Larry allegedly bully Mohbad and assault am many times wit dia gangs.

Police bin say dem also get video evidence wey match di statements of di witnesses wey say bifor Mohbad die im raise alarm say dem dey threaten im life, but Naira Marley and Sam Larry deny say dem get hand for Mohbad death.

For dat same October 2023, Lagos police tok-tok pesin Benjamin Hundeyin say Naira Marley dey dia custody to help police for di investigation of Mohbad death.

Meanwhile, Lagos State Police Command bin charge Naira Marley and Sam Larry bifor one Magistrate court for Yaba, Lagos State.

Di court grant di police request to keep dem for custody for investigation, but for November 2023, both Naira Marley and Sam Larry dey released by di police afta dem meet dia bail conditions.

Even di coroner don request say make Naira Marley and Sam Larry appear for court to come tok wetin dem sabi inside di death of Mohbad, but as you dey read dis tori now, dem neva show.

Make we let you know say afta di investigation, police find out say na di injection wey auxiliary nurse wey dem call to treat Mohbad bin give for 12 September, na im react for im bodi. Na afta di injection Mohbad bin begin react.

According to di police, di auxiliary nurse Feyisayo Ogedengbe don already give Mohbad doses of Tetanus toxins, Paracetamol injection and Setrazone injection intravenously for 11 September 2023 wen she first come dia house.

Wen BBC Pidgin visit di court hearing, we gada say dem carry Mohbad go two hospitals wen im bodi begin dey react to all di drugs and injections wey e don collect.

In fact, di wife confam say dem even gatz carry am put ontop bike wen traffic hold dem for Lekki side, but di hospital tok say dem bring am in dead.

Wetin autopsy tok for Mohbad death?

E no pass 24 hours wen dem finally see say Mohbad die, na im family bury am for Ikorodu, but no be dia e end.

Na even thousands of Nigerian youths bin come out for 21 September 2023 to attend di candlelight procession wey dem do for late Mohbad across major part of di kontri but di one for Lagos state hit pass as dem converge for Muri Okunola Park wit tears, songs and last respect.

Some pipo no still rest, until police tok on 21 September, 2023 say dem dig out Mohbad deadi bodi to do toxicology tests and autopsy.

Dat afternoon, dem carry bodi of Mohbad from Ikorodu reach Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) and e enta di premises around 3pm as na only family dem allow make dem follow di deadi bodi enta.

Plenti pipo bin wait to see di result of di autopsy…. but… no be wetin dem want bin comot.

Veri big controversies dey follow di autopsy results of Mohbad wey come out as pipo no believe am and even di court grant di family opportunity to go do dia own autopsy investigation.

BBC Pidgin even reach out to di National Medical Services, wey dey known as NMS Labs to confam if dem receive test samples of di late singer.

Di lab say dem receive post-mortem samples wey dem identify as “as being from Mr. Aloba” (di late singer) on behalf of di Lagos State DNA & Forensic Center wia dem confam say dem complete di testing ontop di samples of Mohbad wey di Lagos State forensic centre bring and dem give di report since April 2024.

Gbege wit Mohbad autopsy

Anoda wahala begin dey sup wen Sunday Shoyemi wey be pathologist for Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) appear bifor di coroner magistrate court for Ikorodu on Wednesday 15 May wia im tok on di autopsy result.

Local media bin report say di pathologist say di autopsy wey dem do no gree reveal wetin cause di death of Mohbad sake of say di bodi don decompose bifor dem conduct di autopsy.

To add to dat, one legal representative for Mohbad family, add say di pathologist tok say “dem suppose don exhume di bodi within 12 hours so e no go decompose bifor dem do di autopsy”.

As all dis gbege dey happpun, di court later still grant di Mohbad family opportunity to do anoda autopsy to know di cause of death of dia son but say na dem go bear di cost of di process.

Na di stage wey di whole case dey be dis as more witnesses still dey appear for di coroner court to tok wetin dem sabi for di death of Mohbad.

Wen dem go bury Mohbad?

Di father of di late Afrobeat star, Mohbad say im family bin dey wait for di DNA and autopsy result, bifor dem go bury di musician.

Now wey result come out, dem no gree for wetin di result tok and dem wan do dia own independent autopsy.

Nobodi know wen dat autopsy and di result go comot.

Wit all dis gbas-gbos wey dey go back and front, e no clear wen di bodi of late Mohbad go enta ground again for di final time.

Again, for 11 September 2024, fans bin come out for Lagos court again to resume protest to demand justice for late Mohbad.

Maybe na tomorrow dem go bury Mohbad, or na next month or next year- nobodi sabi except di family as di bodi dey lie for morgue.

But one day, dem go pay last respect to late Mohbad so e go fit go rest in peace.

Pipo raise placards to seek justice for Mohbad

BBC
Popular actor Yomi Fabiyi carry placard to seek justice for Mohbad

Source