American singer Mariah Carey lose her mama and sister on di same day

Mariah Carey

Getty Images

American singer Mariah Carey mama and her sister die for di same day.

Di mama wey her name be Patricia and di sister identified as Alison die ova di weekend, di singer tok for one statement.

“My heart dey broken say I don lose my mama dis past weekend,” Carey tok on Monday, 26 August.

“Sadly, in a tragic turn of events, my sister lose her life on di same day.”

Di Grammy-winning singer tok say she feel blessed to don spend time wit her mama for di week bifor her death and ask for privacy.

She no release further details about wetin kill her mama and her sister.

Patricia wey be 87 years na former opera singer and vocal coach of Irish-American descent.

Inside Carey 2020 memoir, The Meaning of Mariah Carey, di five-time Grammy Award-winning singer detail her complicated relationship wit her mama, and tok say e don cause her “so much pain and confusion”.

Carey wey be 55 years tok say competition bin come between dem. Professional jealousy “dey come wit di territory of success, but wen di pesin na your mama and di jealousy dey revealed at such a tender age, e dey particularly painful”, she add.

But she also tok about di deep love she bin get for her mama. She write for di dedication of di book: “To Pat, my mama, wey, through it all, I believe say she actually do di best wey she fit. I go love you di best wey I fit, always.”

For one interview wit Gayle King for 2022, di singer tok say she bin dey “definitely” dey affected by criticism from her mama wen she bin dey grow up.

She add say she bin don always credit her mama wit exposing her to music.

Carey relationship wit her older sister Alison wey be 63 years bin also dey complex.

For her memoir, she write say she bin no dey in good terms wit her mama and her brother Morgan, and add say e bin dey “emotionally and physically safer for me to not to get any contact”.

Alison bin sue Carey for $1.2m (£909,780) afta di release of di memoir for “immense emotional distress”, and she call am “vindictive”.

Di singer papa, Alfred, die for 2002 of cancer at di age of 72.

Dem regard Carey as one of di most successful singers globally.

Her holiday single All I Want For Christmas Is You na di best-selling Christmas song by a female artist of all time.

She hold di record for di most Billboard Hot 100 number-one singles by a solo artist at 19 songs, and she don sell ova 220 million records worldwide, and serve as a judge on di competition show American Idol.

Source