Sam Larry arrest, court agree on witnesses to invite for coroner inquest – Latest on Mohbad death

Di coroner inquest wey dey look into di cause of death of popular artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo know as Mohbad don agree on di witnesses wey go appear for court to give evidence.

For di first sitting wey happun for Candide Johnson court for Ikorodu Lagos on Friday, di lawyers enter close-door session wia dem decide on different matters.

Lawyer to di family of Mohbad, Funmi Falana tok say dis first sitting na to determine who dem go invite as witnesses for court.

“Wetin we do today na to decide how and wen of di procedures wey go help us get justice.”

“We don fix next date and we go bring our witnesses,” she tok.

Lawyer Falana add say make pipo dey hopeful say dem go pursue cause of justice.

“We dey represent di interest of justice, make we allow peace to reign but justice must dey served. We go get to do di root cause of di death.”

Di lawyer wey file di case for inquest into di death of Mohbad, Festus Ogun also reveal say no witness go get di mind not to show wen dem call am.

Im add say e go be contempt of court if witness wey dem call no appear for court and dat go be anoda offense.

“E depend of si number of witnesses wey we get to know how long dis matter go take, but I fit assure say e no go long”

Dey don don set October 13 as date wey dem go begin carry witness enter court for evidences.

Di Corona inquest sit for di first time on Friday afta di Lagos state police command say dem don arrest Balogun Olamilekan Eletu wey pipo know as Sam Larry.

Benjamin Hundeyin, tok-tok pesin of di police for Lagos confam di arrest on Thursday night.

Police bin don invite Sam Larry and artist Azeez Fashola alias Naira Marley for questioning over di death of Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad.

Di names of di two pipo dey prominent among young pipo sake of dia initial relationship wit Mohbad.

Sam Larry and Naira Marley don dey consistent in dia position say dem no get hand for im death.

On Wednesday, Naira Marley for interview say im go only show for di investigation “if police fit guarantee my safety”.

Sam Larry arrest come ahead of di corona inquest on Mohbad death wey dey start on Friday.

Di socialite bin dey do short videos dey drop for social media since tori of MohBad death come out.

Wia im dey record di videos no clear – e neva also dey clear how police take arrest Sam Larry.

What is a corona inquest

Lagos state judiciary set date wey dem go commence coroner inquest into di strange death of late Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad.

Na for one reply letter wey coroner magistrate T A Shotobi bin sign on Tuesday e reveal say dem go begin inquest wey go expose di facts wey dey surround di death of Mohbad.

Inquest na judicial inquiry wey go help ascertain di facts wey surround any incident while coroner na judicial official wey get di power to conduct investigation or inquest into wetin cause di death of pesin.

Wetin inquest go do na to answer questions on how suspicious death bin happen.

BBC Pidgin follow ogbonge lawyer Festus Ogun tok about how dem go conduct di coroner inquest into di death of Mohbad and wetin go happun next.

Oga Ogun say dis particular death of Mohbad dey strange and na why dem go conduct an inquest.

Im also explain wetin coroner inquest mean and why e dey necessary.

“A coroner na judicial system wey make enquiry or investigation into di circumstances surrounding di death of a person in di event say di death no dey natural.”

Source