Wetin di Arabic word Intifada mean for Gaza war protests?

One woman dey shout at policeman

Getty Images

Mass arrest don take place during protests for some ogbonge US universities ova di war for Gaza.

Social posts about di demonstrations dey regularly refer to Intifada – di Arabic word for uprising. Dem dey use am in relation to periods of intense Palestinian protest against Israel.

Many posts ask weda new Intifada go dey as a repercussion of di war for Gaza. Some term am di “Intellectual Intifada” and call to “Globalise di Intifada”.

Students dey waka comot lectures and dey set up encampments to protest against Israel military campaign for Gaza.

Dem don arrest Hundreds of protesters on campuses across di US.

Tents ontop grass for di Massachusetts Institute of Technology for Cambridge, Massachusetts

EPA
Part of one encampment for Massachusetts Institute of Technology

Di institutes include Columbia University and NYU for New York, di University of California for Berkeley and di University of Michigan.

Emerson College and Tufts University, for Boston, and di Massachusetts Institute of Technology (MIT), for Cambridge, don also see protesters.

Dem don suspend many students from Columbia, prompting more voices to call for disciplinary measures to dey dropped or cancelled.

Several Jewish students don express concerns about wetin dem call threatening campus environment.

But oda demonstrators don argue say harassment on Jewish students dey rare and blown out of proportion by those opposed to dia demands.

Activists don dey call for universities to “divest from genocide” and stop investing large school endowments inside companies wey dey involved in weapons manufacturing and oda industries wey dey support Israel war for Gaza.

Getty Images
University students dey protest against Israeli attacks on Gaza as dem set up encampment on di grounds of di University of Michigan

Wetin Intifada mean?

Di Arabic word intifada translate to “uprising”. Dem don use am describe period of serious Palestinian protest against Israel.

Di First Intifada na from 1987 to 1993. Di Second Intifada na from 2000 to 2005.

Since di recent Gaza war start on 7 October 2023, di term “Globalise di Intifada” start on social posts, wey dey call for pipo around di world to participate in rising up against Israel.

Oda term dem don use. Include “Electronic Intifada”, di “Intellectual Intifada” and call to boycott Israeli products (di “Boycott, Divestment, Sanctions” movement).

So wetin we know of di early Palestinian Intifadas?

One activist for Canada wey dey support Palestinian hold banner on 25 April 2024

Getty Images
One activist for Edmonton, Alberta, Canada wey dey hold banner wit di inscription ‘Intifada until victory’

First Intifada: Dec 1987 – Sept 1993

Di first Palestinian intifada start on 8 December 1987 for Gaza, wen Israeli army tank transporter lorry crash into cars containing Palestinians.

Four Palestinians die.

Palestinian combatants wearing a mask over his head with holes for mouth and eyes, crouching on a wall

Getty Images
One Palestinian combatant wey wear mask to hide im identity, e dey patrol im village for di occupied West Bank for June 1989

Frustration among Palestinians wey dey live under Israeli occupation bin don dey grow for 20 years up till dat day.

Israeli illegal settlements for di occupied West Bank and Gaza Strip don dey spread, while Palestinians dey struggle economically and face constant confrontations wit di Israeli army.

Rioters throw stones alongside burning material

Getty Images
Palestinian rioters throw stones at Israeli riot police for di North Jerusalem village of Hizme, on 21 December 1987, declared as “Peace-Day”, in support of Palestinians on di territories wey Israel occupy.

In response to di lorry crash, uprising break out for Gaza Jubalia refugee camp, and spread quickly throughout di West Bank and di Gaza Strip.

Young Palestinians confront Israeli soldiers wit stones and petrol bombs. Israeli soldiers fire live bullets, wey draw criticism from international organisations, including di United Nations.

Violence between di two sides continue, on different levels, until 1993.

Di uprising start as surprise to many parties, including Israel and Yasser Arafat Palestine Liberation Organization (PLO), wey dem exile to Tunisia.

Israeli riot police dey fire tear gas give Palestinian demonstrators

Getty Images
Israeli riot police fire tear gas give Palestinian protesters during clash, on 22 January 1988 for di streets of Jerusalem, afta Friday prayers

One of di main results of di First Intifada na to attract world attention to di suffering of Palestinians wey dey live under occupation , and especially to di hardline measures wey Israelis use to suppress di uprising.

One famous word wey dem bin dey use den na one wey Israel Defence Minister, Yitzhak Rabin use. He call for “breaking di bones” of demonstrators.

Rabin believe say shooting Palestinians go spoil Israel image for di international community, becos firing live rounds at Palestinians without guns go gain dem sympathy.

As di Intifada progress, di Palestinians move on from throwing stones and Molotov cocktails, to attacking Israeli forces wit rifles, hand grenades, and explosives.

Official sources and analysts assess say Palestinians kill more dan 100 Israelis during di first Intifada, while Israeli forces kill at least 1,000 Palestinians.

PLO leader Yasser Arafat (Right) dey shake hand wit Israeli foreign minister Shimon Peres for di Oslo Accord signing wit US President Bill Clinton (Far right) wey dey clap im hands

Getty Images
PLO leader Yasser Arafat (Right) dey shake hand wit Israeli foreign minister Shimon Peres for di Oslo Accord signing wit US President Bill Clinton (Far right) wey dey clap im hands

Di Intifada end on 13 September 1993, wen Israel and di PLO sign di Oslo Accords, wey provide framework for peace negotiations.

Israel accept di PLO as di representative of di Palestinians, and di PLO renounce armed resistance.

One Palestinian militant strap boxes, mark as TNT explosives, on di back of one of im comrades, clearly as a sign say dem dey prepare to carry out suicide bombings, during anti-Israeli protest for di Palestinian refugee camp of Ain al-Hilweh for di outskirts of di southern Lebanese port of Sidon October 2000

Getty Images
One Palestinian militant strap boxes, mark as TNT explosives, on di back of one of im comrades, clearly as a sign say dem dey prepare to carry out suicide bombings, during anti-Israeli protest for di Palestinian refugee camp of Ain al-Hilweh for di outskirts of di southern Lebanese port of Sidon October 2000

Di Second Intifada: Sep 2000 – Feb 2005

Di second intifada wey dem call di al-Aqsa Intifada.

Di al-Alqsa mosque na di third holiest site for Islam and na di flashpoint wey mark di start of five years of violence.

Palestinian leaders use di shrine name to imply say dis na popular uprising and not acts of violence organised by di Palestinian Authority, as Israel bin argue.

On 28 September 2000, di den Israeli opposition leader, Ariel Sharon, wey Israeli soldiers and policemen dey guide, visit di al-Aqsa mosque.

Di den Israeli Prime Minister Sharon wey guards surround am as e dey leave al-Aqsa mosque in 2000

AFP/Getty Images
Di den Israeli Prime Minister Sharon wey guards surround am as e dey leave al-Aqsa mosque in 2000

Dem kill seven pipo in di first day of protests and more dan 100 injure.

Wetin start as hundreds of Palestinian protesters dey throw shoes and stones at Sharon guards lead to demonstrations across di Palestinian territories.

Pictures of di Palestinian 12-year-old boy Mohammed al-Dura wey dem shoot dead for Gaza as im hold im papa, don become some of di most enduring images of di second Palestinian uprising.

Israeli investigation tok say, one French TV news report in 2000 blame Israeli troops for shooting di child dead.

Two images of di boy as e look afraid with im papa arm dey hold im arm for di second image

France 2 / Getty Images
Screenshots from France 2 TV footage of Israeli-Palestinian clash for di Gaza Strip on 30 September 2000 show Jamal Al-Dura and im son Mohammed dey hide behind barrel during Israeli-Palestinian crossfire, moments before di 12-year-old boy die.

Di most serious differences between di uprising of di eighties and di uprising of 2000 na di level of confrontations and acts of violence.

Di Second Intifada dey violent dan di first.

Di UN say more dan 5,800 pipo die since di start of di Second Intifada for September 2000 until di end of 2007 – nearly two years afta di uprising end.

Although figures dey hard to determine di number of pipo wey die during di Intifada, most analysts believe say many more Palestinians die pass di Israeli.

Israeli passenger buses blown up by Palestinian suicide bombers dey wait to dey scrapped for a bus graveyard for di Egged bus facility on 30 June 30 2003 for Qiryat Atta, northern Israel

Getty Images
Israeli passenger buses wey Palestinian suicide bombers blow up dey wait for scrapping for bus graveyard for di Egged bus facility in June 2003

Palestinian method of attack include firing rockets as well as suicide bombings inside buildings and on buses.

International criticism dey on Israel methods of response at times, but di Israelis argue say dem dey respond to organised armed attacks.

Source