Lack of pay TV options dey make Nigerians para

Satellite dishes television

Getty Images

No be tori again say subscription television and pay TV train don dey lose relevance recently.

Dis na as consumers dey move go on-demand Over-the-top OTT and digital video content.

For Nigeria pipo dey vex sake of increase for price of subscription for one popular pay TV.

Dis one dey come afta Multichoice, di owners of Dstv reveal dia new subscription rates early dis week.

Di satellite TV reason of operational costs increase and di need to improve service quality no go down well wit di kontri pipo.

Plenty subscribers of di TV service don enta social media to show say dem no dey happy about di high price wey dem dey pay sake of wetin dem describe as monopoly.

Like many oda kontris, Nigerians dey rely on pay TV to fit keep track of wetin dey happun around di world.

Na only a few of dem dey operate currently for di West African kontri.

Some pipo tok say dem fit need to look for oda options as di platform only dey popular to dey show live football game and movies wey no too new.

But many options no dey – di likes of Amazon Prime Video and Netflix fit only offer entertainment contents.

Local tori pipo News Agency of Nigeria say Multichoice currently dey enjoy di monopoly of satellite television service providers for Nigeria.

Meanwhile di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) tok say dem go review di recent price increases di cable subscriptions just announce.

Adamu Abdullahi wey be acting CEO of di consumer protection join bodi wey tok for interview wit tori pipo Channels say di move na to make sure say subscribers for Nigeria get value for dia money.

Multichoice no be visitor for di Nigeria business environment, di South African company bin start operations for di West African kontri for 1993.

Oda times wey Nigerians go see increase for di payTV subscription

No be di first time wey Multi Choice go announce increase for price of dia service be dis.

E don almost become one regular tin for di cable service provider and dis no too sweet for Nigerians belle.

For March 2022 Multichoice bin increase price of dia service for DStv and GOtv packages for Nigeria.

Den, civil rights groups bin chook mouth for di matter.

Di rigths group Huriwa bin ask di federal goment and National Broadcasting Commission and oda ogbonge agencies dem say make dem force MultiChoice to charge Nigerians per view or make dem sanction di company say dem no compliance failure.

Di Senate on 30 Wednesday 2022 for plenary bin also form one seven-man ad-hoc committee say make dem chook eye for di tariff hike by Multi-Choice Nigeria.

Na one Senator Patrick Abba Moro wey bin represent PDP Benue South present motion wey im bin title, “Nigerians dumbfounded, outrage over Pay-Tv Tariff Hikes, demand for Pay-Per-View subscription model”.

For April 2023, Multichoice bin also announce increase for dia DStv, and GOtv subscription rates.

Six months ago DStv again announce 19% increase for price of subscription for dia package.

Di announcement wey bin shelle for late 2023 no meet Nigerians for well, many pipo bin tok say no be say di price hike go match improvement for service.

E mean say for less dan three years, di Pay-TV service provider don increase prices four times- March 2022, April 2023 (17% increase), December 2023 and April 2024.

Source