‘Spice and herbs better pass seasoning cubes’ – Niqab chef provide alternative to maggi

The British Broadcasting Corporation

Nigerian chef, Sherifah Yunus dey cook different local and foreign meals wit her face fully veiled while wearing Niqab inside her kitchen.

Di self-trained chef follow BBC News Pidgin tok about her culinary journey of ova 30 years and why she begin cook wit healthy natural spices.

Yunus get unique cooking style as she no dey use monosodium glutamate (MSG) to build the burst of flavor and taste inside her food – na only natural spices she dey put for her dishes.

Monosodium glutamate na flavour enhancer wey dey inside seasoning cubes, wey many Nigerians sabi as ‘maggi’.

Di chef tok say her family bin sick sake of dia high consumption of sodium, na dis make her begin research about oda better natural alternatives.

Yunus explain say her herbs and spices get “medical proven benefits” wey don help her family and customers.

“For me and my family we bin dey sick. We dey highly medicated so I tink wetin be dat tin wey we dey consume everitime. We consume soft drink, we consume bread everi time and season cube,” she tok.

“I decide to comot MSG make we try natural spices and herbs.”

Yunus tell BBC News Pidgin say she bin like how Muslim females dey dress na im make her dey wear Niqab and no be her husband tell am make she wear am becos she no go gree marry man wey no allow am wear Niqab.

She tok say get plenti staff wey dey handle different departments on her behalf becos na only women fit her face becos she no dey gree reveal her face to male customers.

“If na woman come our office say dem wan see my face no problem but na men I no go comot my face veil,” she tok.

Source