Latest on di $13bn coastal highway wey go bring multi-million dollars Landmark investment down

New informate don come out on di multi-million dollars landmark investment wey federal goment wan demolish to build Lagos-Calabar coastal highway project.

Management of Landmark Africa on Thursday raise alarm ova di ongoing sand-filling wey dey happun for di resort centre afta federal goment send dem demolition notice.

Di management tok say goment neva officially consult dem on di coastal highway alignment and dem neva discuss di Environmental Impact Assessment (EIA) of di project on Landmark wit di management.

Landmark express dia fear say di ongoing sand filling wey dem happun for dia beach shoreline don dey cause fear among independent businesses, suppliers, employees, investors, financiers, and clients wey dey do dia business witin di Landmark Ecosystem.

On Wednesday, Landmark Africa ontop dia X page share videos of federal goment sand-filling portion of di beach front.

While reacting to di recent development, Elsie Ogianyo, tok-tok pesin for Landmark Africa tok say ova 80 businesses don invest between15-20bn naira ($12m) while Landmark don invest 25bn naira ($21m) on di infrastructure wey dey di resort centre.

“As business wey don dey in operation for ova 27 years, in 14 cities across 3 continents, and we don dey operate from our site at Water Corporation Road for ova 17 years, we dey proud to don bring in ova $100 million of foreign direct investment and local facilities to develop di tourism ecosystem we get today,” di statement tok.

“In di wake of di news of di last couple of weeks, our FDI investors don express alarm, so we dey eager to get past dis season of turmoil and uncertainty so we go fit return to growing di most celebrated tourism destination on di West African coast.

“We look forward to working continuously wit di Lagos State goment to achieve win- win solution wey go preserve di Landmark Beach, retain di ethos of di coastal road, and maintain Lagos and Nigeria as beacon for positive development in di tourism industry.”

FG go spend $12.56bn on 700km Lagos-Calabar Coastal

Inside one interview wit Channels TV, minister for works, David Umahi tok say goment go spend $12.26bn to complete di 700-kilometre Lagos-Calabar coastal highway project witin eight years but dem still dey negotiate di building project wit partners.

“We dey look at eight years. If I do di tentative calculation e go cost 15trn naira for di project,” di minister tok.

E explain say dem go charge average of 3,000 naira per vehicles wey wan use di road daily so dem go generate about 300 million and within15 years dem go generate dia money back.

On April 5, Landmark issue press statement on X asking federal goment make dem re-route di first 1.5km of di Lagos-Calabar coastal project to di original location along di undeveloped Water Corporation Road median so dem go fit minimise di demolition on businesses and infrastructure.

However, wen di minister for works tok to tori pipo e say di Lagos-Calabar Coastal highway project no go affect di infrastructure and job employment for Landmark beach but visitor no go fit visit di beach shoreline becos of di highway construction.

E add say e don meet wit di company director and advise say make dem build di beach to a different location but e no go fit promise say demolition no go affect some areas becos e go affect pipo residential building.

Aside Landmark Africa e go also affect some businesses and infrastructure as federal goment don give demolition notice to Beach Resort, Kids and Bay Arena, Members Area and Lagos Beach Club.

Di goment tok say di facilities dey witin road by 50 metres and many investment go dey affect.

Wetin we know about Lagos-Calabar coastal road wey federal goment wan spend $12.56bn

For September 2023, Federal goment award di construction of di Lagos-Calabar Coastal Highway to Hitech Road Construction Company.

Di Lagos-Port Harcourt-Calabar Coastal Highway na di first of im kind in di whole of Africa.

Na 700km long costal road project wey go connect Cross-River and Lagos States witin 7hours travel.

Di first phase of di new 700km highway go run through di nine coastal states 47.47km sections and e go get five lanes on each side of di dual carriage way and train railway for middle.

E go also compress di distance between Lagos and Ondo State witin one hour travel time. Di distance from Ibeju-Lekki in Lagos to Araromi in Ondo State go be about 50 kilometres along di coast.

Upon completion, e go also connect di Lekki Deep Seaport and the Lekki economic corridor wia Dangote Refinery and Petrochemical Complex dey wit oda multinational industries.

Source