Glovo na di latest company to join Jumia foods and odas wey close dia business for Ghana

Man carry bag wey dem crest Glovo ontop

Getty Images
Glovo enta di Ghana market for 2021, afta dia Africa invasion for 2018

Glovo, wey be popular food delivery platform say dem go stop dia operations for Ghana on 10 May.

Di company tell dia network of restaurant partners and odas for one e-mail say di decision na as a result of “profit wahala for di Ghana market.”

Dis na despite plenti investment di company don make to expand dia services ova di last two years.

Glovo explain say dem wan focus for dia presence inside Morocco, Uganda, Kenya, Ivory Coast and Nigeria.

For di e-mail, Glovo tok dia partners say, “we go close our Ghana operations by 10 May at 10:00 pm, wey we go close di app.”

“We sabi say Ghana market get potential, but to make profit go require substantial investment for a long time. Dis be why we don decide say we go redirect our resources to di oda 23 kontris wia Glovo dey operate,” di company tok.

Glovo enta Ghana for 2021 afta dem carry dia operations enta Africa for 2018.

Glovo na di second food delivery company wey dey pack dia bag comot Ghana for di last six months.

Jumia foods also comot Ghana

Anoda enterprise wey pack out of di kontri na Jumia foods.

Di pan-african e-commerce food delivery service at di end of December, exit seven markets including Nigeria, Kenya, Uganda, Morocco, Tunisia, Algeria and Ivory Cost because of “operational and macroeconomic wahala”.

Jumia tok say dem see di “warning signs for 2022 when di company start to cut cost across dia operations.”

Na so dem stop dia food delivery operations for Ghana.

Di e-commerce platform however continue dia physical goods business for Ghana and oda kontris, afta di restructuring.

Dis restructuring don cause reduction for di workforce wey some pipo lose dia jobs.

According to Jumia, dis adjustment go make dem go achieve “efficiency and profitability.”

Apart from dis two food delivery companies, oda business start-ups and enterprises also fold up ova di economic wahala.

BIC relocate pen production to Ivory Coast

For March dis year, afta di president deliver im state of di nation address, one legislator don tok for parliament say some companies dey pack commot di kontri sake of di economic pressure.

During di debate inside parliament, minority leader, Dr Cassiel Ato Forson tok say pen manufacturer, wey dia name na BIC, don move dia production operation to Ivory Coast.

Dr Ato Forson explain say “due to di economic challenge for di kontri, BIC don stop production of pens inside dis kontri. We don export jobs to Ivory Coast, dis na bad news for Ghana.”

Source