‘I no touch her na only on phone we dey tok’ – cosmetic Dr Esho tok afta UK tribunal remove im practice licence

One tribunal bin find Dr Esho fitness to practise dey impaired because of im misconduct

Getty Images
Dr Tijion Esho

Di Medical Practitioners Tribunal Service (MPTS) don remove popular Nigerian cosmetic doctor from dia medical register.

Dis dey come afta one tribunal find Dr Oluwafemi Esho wey pipo sabi well-well as Tijion guilty of di accuse say e give one patient free botox in return for sex for im clinic.

Dr Tijion Esho, wey be TV cosmetic doctor and wey don feature on ITV This Morning, BBC Morning Live and E4 Body Fixers, admit say im bin get improper relationship wit one woman for Newcastle, but deny say im no dey physical wit her.

Dr Esho describe im communication wit di patient as “wrong and foolish”.

One tribunal rule say Dr Esho no go fit practice sake of im misconduct.

MPTS announce say dem bin decide for one private hearing to erase Dr Esho from di medical register.

Dem go release di tribunal reasons why dem impose di sanction next week.

Dr Esho bin admit to improper emotional relationship wit di woman, dem refer to as Patient A, pesin wey e bin dey exchange “inappropriate” sexual messages on Instagram wit.

But di 42-year-old tell MPTS hearing say im no ever get any physical sexual contact wit Patient A, wey dey provide sex services via OnlyFans and webcams.

Di panel wey sit for Manchester, rule say Dr Esho bin get sexual intercourse wit Patient A for im clinic for Newcastle for 2021 and e give am Botox free of charge.

Dem also rule say e tell di patient say “im fit get away wit giving her Botox in exchange for sexual services”.

Di panel also conclude say im and di woman bin get sexual contact for previous consultations.

Di panel rule say di conduct of doctor Oluwafemi Esho, dey sexually motivated, but Patient A no dey vulnerable becos of her profession.

Dr Esho tok say im don “let many pipo down” and add say im “fully accept say dis behaviour as a medical professional and doctor no dey acceptable”.

“However, I repeat categorically say di communications no ever cross enta physical sexual contact,” e tok.

“Despite today decision, I remain as committed as ever in ensuring all patients for our clinics, many of whom don show incredible support ova di past few months, kontinu to receive di highest standards of treatment and care.”

Celebrity clients

Dr Esho don feature on ITV morning programme to provide im medical opinion and comment on cosmetic surgery discussions.

Body Fixers for E4, one channel wey Channel 4 dey operate also dey consult di doctor regularly. E also feature on segments of BBC Morning Live until di summer of 2022.

Dr Esho na di founder of di Esho Clinic, wey get location for London, Liverpool and Dubai, and don host plenty celebrity clients.

Botox na protein wey dem make from Botulinum toxin, e dey temporarily paralyze di muscle.

Wen doctors use am correctly in small doses, e fit reduce skin wrinkles and help treat some kain medical conditions.

Di Food and Drug Administration (FDA) don approve am as treatment for various health issues, including excessive sweating, eyelid spasm, some bladder disorders, and migraine.

Source