Rihanna tok why she no wear maternity clothes wen she get belle

Rihanna for one Fenty Beauty launch

Getty Images
Rihanna wen she get belle of her first child for 2022

Pipo don hail Grammy-award winner Rihanna for rewriting di rules of fashion wen she get belle as she no gree wear maternity dress wey women dey like wear wen dem carry belle.

Rihanna tell BBC say she bin no gree buy maternity clothes and she just wear wetin she dey comfortable in.

“I just wan do things my way. I just wan always stitch am up and put my own twist on am.

“But I just refuse to buy maternity clothes, really and truly. I be like, whatever fit and anytin wey work. And dat decision make me challenge myself to get clever wit style.”

Di multi-Grammy Award winner get two sons wit rapper A$AP Rocky – she born RZA Athelaston Mayers for 2022, and Riot Rose Mayers for 2023.

Writing about Rihanna maternity style, Vanessa Friedman tok for di New York Times say she “get history of consciously using her own physicality and profile to force reconsideration of old prejudices and social conventions about female agency and beauty”.

Many pipo like her high fashion sense wen she get belle and afta her pregnancy.

Refinery 29 Venesa Coger tell di Guardian for 2022 say Rihanna bin make am “OK to still enjoy di fashion styles you love wearing even before you get belle”.

Rihanna on her ‘rediscovery’ afta she born children

Rihanna in London

Getty Images
Rihanna show off blonde fringe for di launch of her new Puma shoe for London on Wednesday

Rihanna don tell BBC say her ability to fit wear fashionable clothes for public again afta two children don lead to personal “rediscovery”.

Afta I born my children, fashion become “di least important” thing, she tok.

“Wit di first belle, e be like say, I fit wear heels all through di pregnancy,” she tok.

“But wit di second belle, you get small pikin for hand, you get belle, na winter season, you carry coat, plus baby bag. At dis point, you go think twice before you wear heels. Dat na why I become a little more creative wit my comfortable style.

“I bin become too comfortable wit long free dress, PJs, sweats afta I born my second child.

“And now I dey play again. Now I dey have fun wit my clothes.”

Di star bin attend di London launch on Wednesday, days afta she show for di Coachella festival for California.

Returning to di spotlight and thinking about fashion again don giver her “a rediscovery” plus di licence “to even allow myself that space mentally to approach my closet and create stuff”, she tok.

Di 36-year-old star bin step away from music in recent years, di last album she release na for 2016.

Say she no dey sing again, no stop her from becoming a self-made billionaire, and she dey estimated to worth $1.4bn (£1.12bn), according to Forbes.

Her income na mostly from her make-up and skincare brand Fenty Beauty and lingerie brand Savage x Fenty.

She show on few tracks in recent years, including Lift Me Up in 2022, di lead single for the Black Panther: Wakanda Forever Soundtrack.

She bin reveal her second pregnancy during di 2023 Super Bowl half-time show, her first live performance in more dan five years.

Ova 121 million viewers watch di event wey make am di most-watched half-time show for history.

Source