Zamfara state latest kidnap: Gunmen attack school kidnap plenty students – Reports

Zamfara state latest kidnap:

Getty Images

Gunmen on Wednesday morning attack secondary school wia dem kidnap plenti students for Zamfara State.

According to reports, di kidnap happun for Maradun Local Goment Area of di north west Nigerian state on 1 September, 2021.

Residents of di town tell BBC say di gunmen attack early mo-mo and kidnap a high number of students but dem no know di exact number.

Reports say na over 400 students dey di school from di time of di attack.

Dis na students wey dey write mock exams in preparations for final secondary school year.

One teacher for di school wey speak to BBC yan how di thing happun.

“We just dey start today paper and dey discuss with di students dis morning na im we hear sounds of plenty motorcycles.

“And after few seconds we just see di attackers na so we start to run enter nearby farms alongside some students but dem kidnap di rest go.”

Zamfara state don become hotbed for kidnapping for ransom.

E no too tay wey gunmen attack college of agriculture for Bakura town kidnap students.

And months ago dem attack Jangebe school to kidnap students.

Zamfara Police Command neva tok anything on di mata as di tok tok pesin Shehu Mohammed no respond to calls or messages on di issue.#

Dis latest kidnapping happun just days afta more than one hundred kidnapped students for three schools regain dia freedom afta many days for captivity.

More than one 1,000 students don dey kidnapped since December – most of dem get freedom afta dia family reportedly pay ransom to di gunmen.