Federal government declares public holiday for Eid Kabir 2021 celebration

Muslim faithful celebrate di end of di Ramadan fasting

Getty Images
Muslim faithful celebrate di end of di Ramadan fasting

Nigeria goment don declare Tuesday July 20 and Wednesday July 21 as public holidays to mark dis year Eid-el-Kabir celebrations.

Di kontri interior minister, Ogbeni Rauf Aregbesola, wey make di announcement, also congratulate Muslims for di kontri plus all di kontri pipo wey dey inside Nigeria plus di once wey dey yonder for dia occasion.

Di goment assure all Nigerians of dia commitment to make sure say di life and property of every Nigeria dey safe.

Di minister encourage di Muslim followers to embrace di spirit of peace, love, kindness and sacrifice and to also use dis period pray for di kontri unity.

Wetin be Eid Kabir?

Eid el Kabir wey some pipo dey call ‘big or ram sallah’ na one of di two Eids muslims dey celebrate.

E dey happun on 10th day of Dhul Hijja wey be last month for Islamic calendar.

One of di significance of Eid Kabir for Muslims na say dem go get reward for every hair wey dey di body of animal wey dem slaughter.

For pipo wey dey do Hajj na one of di important things as dem go slaughter ram and give out to charity.

Na time wey family visitations dey very important and get plenti reward according to Muslim beliefs.

Reminder to observe Covid guidelines

As Nigerians dey prepare to celebrate di Eid festival, di National Economic Council don remind kontri pipo to make sure say dem strictly observe di Covid-19 guidelines.

Di reminder dey come afta di council receive regular state performance report from di Nigeria Centre for disease Control (NCDC).

Recently, di number of Covid-19 infections don dey rise again for Nigeria and Lagos state get between 70 to 80 percent of di cases, according to NCDC.