School resumption in Nigeria: Why Cross River postpone dia 16 June back to class plan

Children dey study for school Nigeria

Getty Images

Cross River state don postpone di resumption of schools till further notice.

Di state for di south south of di kontri bin dey plan to test run di resumption of schools today, 16 June, 2020.

Di plan before na for three schools to resume for di three senatorial districts.

Goment suppose monitor dem for di next 14 days and do community before oda schools go dey allowed to resume.

Cross River for become die first state for Nigeria wia schools for resume.

Na since March 26 federal goment close down all school for di kontri sake of coronavirus.

Di state goment bin roll out measures for schools to follow wen dem resume, like di wearing of face masks and face shield to school.

Oda measures na di washing of hands plus di use of hand sanitizers join.

But one goment official for di state tell BBC Pidgin say di state get plenty pressure from federal goment ontop dia plan to resume.

Some organisations like di Nigerian Medical Association and concerned parents also no buy di idea.

On Monday 15 June, 2020, di Presidential Task Force on Covid-19 for di kontri tok say e no dey safe to reopen schools, television viewing centres and oda areas of public interest.

Di PTF Chairman and Secretary to di Government of di Federation, Boss Mustapha, say:

“We don receive reports say some states dey reason di opening of schools, television viewing centres, sports stadium and oda places wia large gatherings fit happun.

“The Presidential Task Force dey tok again say e no dey safe yet to do so and make dem exercise utmost caution in dis regard,” e tok..

Cross River na di only state for Nigeria wey never record any case of coronavirus according to di kontri Centre for Disease Control.