Nigeria mourn deaths of three movie stars inside one week

Di death of Adejumoke Aderoumu on Saturday, 6 April, Saratu Gidado on Tuesday, 9 April and dat of Junior Pope on Wednesday, 10 April don throw di whole kontri, particularly di entertainment industry into mourning.

President Bola Tinubu, politicians, celebrities, plus fans of di actors don express dia condolence as dem send dia tribute to di departed souls.

Concerns also dey say dis deaths don become one too many for di feem industry.

Adejumoke Aderounmu

Na di news of di death of Jumoke Aderounmu ova di weekend bin first throw di feem industry into shock.

Ms Aderounmu bin become popular afta she feature as Esther for Jenifa’s Diary – one television series wey Nollywood star, Funke Akindele produce.

Di deceased brother, Adeola Aderounmu confam her death.

Following her death, many drama don occur wey lead to gbas-gbos between di brother of Jumoke and producer of Jenifa’s Diary as e accuse her say she no show concern wen im sister dey alive.

However, for di middle of all di kasala, family of Ms Jumoke release one statement on Wednesday, 10 April wia dem beg evri one to stop dey engage or spread unnecessary controversies wey no honour Jumoke legacy.

Di family wey call for privacy during dis period describe Jumoke as “beacon of joy and kindness wey touch di lives of evri one she meet wit her vibrant spirit and infectious smile.”

“As we navigate through dis period of mourning, we kindly request make una respect our privacy. We beg evri one to stop dey engage or spread unnecessary controversies wey no go honour Jumoke legacy of love and light.

Now no be time for disputes; na time to remember her for di genuine warmth she extend to all.

Ms Motunrayo Adeyemi, Jumoke eldest sister wey sign di statement on behalf of di family, say make pipo stop dey drag her name.

“Please, make we allow her spirit to rest in peace,” she tok.

Ogbonge Kannywood actress Saratu Gidado

Ogbonge Kannywood actress, Saratu Gidado, die on Tuesday, 9 April. Family of di late actress confam her death.

Dem say afta she chop Sahur, di food wey Muslims wey dey observe Ramadan dey chop, she go inside go sleep and she no wake up again.

She die at di age of 56 for Kano State.

Popularly known as Daso, she dey well known for di comedy roles she always dey play.

Tributes for Jumoke, Saratu and Junior Pope

Plenty tributes don pour in for di deceased actors. Plenty pipo enta social media to express dia sadness and sympathise wit di families of dose wey pass on.

President Bola Tinubu for im condolence message to di family, colleagues and fans of di veteran Kannywod actress, Saratu Gidado, tok say di entertainment industry go miss di actress.

Labour Party presidential candidate for di 2023 general elections, Peter Obi, say di death of Junior Pope and Saratu Gidado na great loss to di entertainment industry. E tok sorry to di family of di actors.

“Ova di past two days, di Nigerian entertainment industry don suffer great losses wit di passing of two prominent figures: veteran Kannywood actress, Saratu Gidado and Junior Pope. Dis sudden losses represent significant tragedy for our entertainment industry,” former Senate president Bukola Saraki tok.

Celebrities like singer Kcee post say, “Dis dey too sad.”

Actress Yvonne Jegede, write, “I no fit believe am. I no wan believe am. I refuse to believe am. Who go ask me “Who does dat, wen next dem see me.”

Toyin Abraham say, “Jnr Pope, I don tire and off for now, dis dey too much.”

Nigeria police mourn Junior Pope and im colleagues

Nigeria Police Force don dey torchlight di cause of di accident wey lead to di death of Nollywood actor, John Paul Odonwodo, wey pipo sabi well-well as Junior Pope.

Di Force tok-tok pesin Olumuyiwa Adejobi give di informate on X (former Twitter).

Junior Pope bin drown afta boat wey im and some movie crew members dey inside bin capsize for River Niger on Wednesday, 10 April.

Di police express dia condolence to di Actors Guild of Nigeria, families and fans of di late actor.

“As investigations into di cause of di accident continue, we join for di mourning of di lives cut short and pray for di peaceful repose of dia souls.”

Dis dey come as Nigeria dey mourn di death of three movie stars wey die within one week.

Source