Nine-month-old baby dey for surgery, im mama and five odas die for Sydney stabbing attack

Sydney stabbing

Getty Images

Authorities for Australia don confirm say six pipo don die afta one man stab dem wit knife for Westfield shopping centre for Bondi junction, Sydney.

One nine-month-old baby dey among di pipo wey di man stab and di pikin dey currently undergo surgery.

Di pikin mama na one of di victims of di stabbing and she don die, local media report.

Police for Sydney don shoot di man dead.

Crowds bin run comot for Westfield shopping centre for Bondi junction wia local media say five pipo don die.

Police bin declare a critical incident afta shooting of a man just bifor 16:00 local time (07:00BST; 08:00GMT) afta reports of stabbings.

Di incident dey currently go on and dem don urge pipo to avoid di area.

Video footage show dozen of police and ambulance vehicles for di scene, and images on social media appear to show multiple casualties, as well as one man wey dey carry large knife.

One eyewitness tell Reuters news agency say dem see pesin wey lie down down injured and dem look wetin dey go on.

“Den we saw all dis pipo wey dey run towards us and den we hear one shot and my husband drag us into di Adairs shop and den we get di lady dia trying to lock di doors and den she no fit lock di front door so we enta di office wey dey all locked and den we dey inside until di police come get us.”

Sydney stabbing

Getty Images
Paramedics wit stretchers outside di Westfield Bondi Junction shopping mall afta a stabbing incident for Sydney on April 13, 2024.

Eyewitnesses tok wetin dem see

Eyewitnesses don describe di kasala and horror as dem run comot from di busy Sydney shopping mall.

“Na madness,” one woman wey dey para well well tok, as she described how she see one woman wey wound lie down for floor.

Dem see crowds of pipo dey run comot from Westfield shopping centre for Bondi for di east of di city as dozens of emergency vehicles dey respond to di incident.

One Officer shoot di attacker dead, police tok.

Anoda eyewitness say im hear “pipo dey shout and scream as dem dey run”.

Im say im follow one policewoman bifor im see one man wey dey come towards dem wit one “big blade”.

“Im just start to waka towards us and all wetin I bin hear na ‘put am down’ and den she shoot am. If to say she no shoot am im for continue to waka, im bin dey on rampage.”

Im tok say di man look like pesin wey dey “on a killing spree” and say im see two deadi body of one man and one woman near one wedding shop.

Anoda eyewitness tell Reuters news agency say im bin see pesin wey lie down wit wound and and im bin dey look to see wetin dey happun.

“Small time we see all dis pipo dey run run towards us and den we hear one shot and my husband dragged us inside di Adairs shop and den we got tell di lady for dia to lock di doors. She bin no fit lock di front doors so we enta di office and we lock oursefs inside dia until police come carry us.”

Australia prime minister say dem don brief am about di incident.

“Tragically, dem don report multiple casualties, di first tin wey dey all Australians mind na “which pipo dey affected and dia loved ones,” im write for X.

“Our hearts go out to di pipo wey wound and we offer our tanks to di pipo wey dey care for dem as well as our brave police and first responders.”

Westfield mall na major shopping centre for di east of Sydney central business district and close to di famous Bondi Beach.

PM praise ‘hero’ female officer wey shoot di suspect dead

 Anthony Albanese

BBC
Anthony Albanese praise police officer wey shoot di attacker dead

For one press conference, Australian Prime Minister Anthony Albanese, express im condolences to di victims of di attack.

E tok say police don confirm say na six pipo di man fatally stab while several pipo dey receive treatment for hospital sake of dia injuries.

“Wetin we fit say for sure tonight be dis: To any Australian wey dey affected by dis tragedy, evri Australian dey wit you,” di prime minister tok.

Albanese also single out di police officer wey shoot di attacker dead.

“I speak bifor about di bravery wey don dey exhibited here, di bravery of di police officer … she enta di proceedings wey bin dey take place, obviously veri dangerous by herself,” di prime minister tok.

“She certainly be hero. No doubt say she save lives through her action.”

Witnesses for di scene don dey describe how di officer run towards di man, and tell am to put down im knife, bifor im shoot am once for chest.

Di officer bin attempt to perform CPR on di attacker, wey later die, authorities tok.

Source