Wetin dey cause kasala between Israel and Iran?

Israel-Iran: Sirens ring thru Jerusalem as objects shoot down from sky
The British Broadcasting Corporation

Anoda kasala don begin happun, but dis time around na between Israel and Iran.

Israel say dem and dia allies don intercept di vast majority of more dan 300 drones and missiles wey Iran launch.

Dem add say e hit some small parts of dia territory, including di IDF base for southern Israel wey wound one small pikin.

Meanwhile, Israel minister of defence, Yoav Gallant, say di confrontation wit Iran “no dey over yet.

Iran retaliatory attack mark di first time wey dem target Israel directly from dia own soil.

Di attack on Tehran na retaliation for an Israeli strike wey kill one Iranian military commander for Damascus early dis month.

Sirens bin dey sound across Israel and dem also hear loud explosions over Jerusalem, wit air defence systems wey dey shoot down objects over di city

President Biden tell Israel say American support for dia ally dey “ironclad”, (strong well well) and di US help dem “take down nearly all of di incoming drones and missiles”.

Iran vs Israel

Reuters

Meanwhile UN Secretary General Antonio Guterres don condemn di Iran attack on Israel, e say e dey beg “all parties to exercise maximum restraint”.

“I dey beg all parties to exercise maximum restraint to avoid any action wey fit lead to major military confrontations on multiple fronts in di Middle East,” im writes for statement.

“I don repeatedly stress say neither di region nor di world fit afford anoda war.”

Why is Iran attacking Israel?

Iran bin don dey give warning since say dem fit launch attack on Israel to retaliate to one strike on di Iranian consulate building for Syria capital, Damascus, early dis month.

Syria defence ministry bin say Israeli aircraft target di Iranian consulate building, wey bin dey on a highway for western Mezzeh district of Damascus, from di direction of di occupied Golan Heights.

Syrian air defences shoot down some of di missiles wey dem launch, but odas pass through and “destroy di entire building, di missiles kill and wound evribody wey bin dey inside”, di ministry add.

Di strike kill seven of Iran Islamic Revolution Guard Corps (IRGC) officers, including top commanders Brig-Gen Mohammad Reza Zahedi and Brig-Gen Mohammad Hadi Haji-Rahimi.

Israel no confam or deny di attack, dem bin tok say dem no dey comment on foreign media reports.

However, Israel acknowledge say dem carry out hundreds of strikes in recent years on targets for Syria, wey dem tok say dey linked to Iran and allied armed groups wey dey armed, funded and wey di Revolutionary Guards dey train.

Reports say Israeli strikes bin step up since di start of di war for Gaza for October last year in response to cross-border attacks on northern Israel by Hezbollah and oda groups wey Iran dey back up for Lebanon and Syria

Syria Foreign Minister ,Faisal Mekdad say im strongly condemn wet callin im call “dis heinous terrorist attack”, im add say e bin don kill “a number of innocent pipo”

Iran vs Israel

BBC

Meanwhile Iran don warn Israel on Sunday say make dem no respond to dia attack on Israeli territory.

Dem add say di next steps go dey bigger if e happun.

Di Iranian armed forces chief of staff, Major General Mohammad Bagheri, tell state TV say if Israel retaliate, Iran response go dey “much larger” dan di overnight bombardment, Reuters reports.

Iran also warn Washington say backing Israeli retaliation fit make dem to begin target US bases.

Earlier, Iran mission to di UN bin cite di UN Charter provision for self defence, under Article 51, and say di kontri consider “dis mata concluded” afta di barrage against Israel, as dem also warn Israel say make dem no make “anoda mistake”.

World leaders condemn di attack

For statement, President Joe Biden condemn di attack against Israel “in di strongest possible terms”, and im tok say US aircraft and missile defence destroyers wey dem send to di di region bin help Israel repel di Iranian assault.

Dem no hit any US forces drone for di attack, Biden tok and di Israelis bin manage to take down nearly all di incoming drones and missiles.

Earlier in di day, di president cut short im weekend wey im go for Delaware to hold urgent meetings wit im National Security team for di White House.

US and Israeli defence and security officials bin dey in close contact as di Iranian attack bin dey happun.

President Biden say im go host a meeting of G7 leaders later on Sunday.

UK PM Rishi Sunak don also condemn di “reckless attack” in di “strongest terms”. Im say di strikes “risk inflaming tensions and destabilising di region”, im add say Iran don “show dia intention to start kasala for dia own backyard”.

Rishi Sunak

PA Media

“Di UK go continue to stand up for Israel security and dat of all our regional partners, including Jordan and Iraq. Alongside our allies, we dey urgently work to stabilise di situation and prevent further escalation. Nobodi wan see any more bloodshed.”

E also confirm say UK jet shoot down a number of Iranian attack drones.

Di UK participate in one “international coordinated effort” to intercept di missiles and drones Iran bin fire, e tok.

“Di RAF send additional planes to di region,” e add.

“Wetin we need now na for calm heads to prevail,” e tok. E add say di UK go work wit dia allies to de-escalate di situation.

Canadian PM Justin Trudeau don tok say im kontri “unequivocally condemn Iran airborne attacks”, im add say “we stand wit Israel”.

“Afta dem support Hamas brutal October 7 attack, di Iranian regime latest actions go further destabilise di region and make lasting peace more difficult.”

French foreign minister Stephane Sejourne tok say France “condemn in di strongest terms di attack wey Iran launch against Israel”.

French foreign minister Stephane Sejourne tok say France “condemn in di strongest terms di attack wey Iran launch against Israel”.

“As dem decide on such unprecedented action, Iran dey take a new step for dia actions to destabilise, and dem dey take di risk of military escalation,” Sejourne tok.

German ambassador to Israel Steffen Seibert tok say, “Germany solidarity dey wit all Israelis tonight wey Iran dey terrorise wit dis unprecedented and ruthless attack: Jews as well as Arabs and Christians, di Bedouins for di Negev as well as di Druze for di Golan. Make all of dem dey safe.”

Russia say make both sides calm down

Russia don tell Iran and Israel to calm down as dem express concern” ova further escalation afta Iran launch missiles and drones at Israel overnight.

“We dey count on di regional states to solve di existing problems wit political and diplomatic means,” di foreign ministry tok for one statement.

Moscow add say dem don warn numerous times say di UN Security Council dey unable to “adequately” respond to a strike on one Iranian consulate for Syria, wey kill seven officers from di Islamic Revolutionary Guard Corps, including top commanders.

Dis dey come afta United States, Britain and France oppose one Russian-drafted UN Security Council statement wey suppose condemn one attack on Iran embassy compound for Syria.

Iran bin accuse Israel of carrying out dat attack, but Israel tok say dem no dey comment on foeign reports.

We dey update dis tori

Source