Wetin Nigeria goment tok about di earth tremors wey happen for Abuja plus wetin you need to know

Pipo for several areas of di Federal Capital Territory don dey speak out about dia experience of earth tremors for di last few days.

Di areas wey experience di tremors pass na Mpape, Maitama, Gishiri and Katampe areas, and dose places na rocky areas and dem dey popular for rock blasting activities.

Earth tremors na small small earthquakes wey dey cause di ground to shake and na di same tin wey dey cause earthquakes dey cause am, but e no dey as severe as earthquakes.

According to di Nigeria Geological Survey Agency, more dan 40 of di tremors don happen for di areas between September 13 and 17, 2024 based on report from dia monitoring station for Katampe.

“We bin record one small event on 13 September. We capture six events on di 14th, more dan 21 events happen on di 15th wit higher intensities. Also, more dan twenty events bin dey recorded on di 16th of September. Di intensity and frequency of di tremor be like say e increase from di 13th to di 16th of September. We also record few weak events on 17th September,” di geological agency tok for inside dia statement on Wednesday.

Di agency also tok say dem later visit some of di affected areas to tok to di pipo wey dey live dia, and from dia witnesses, dem conclude say di tremors happen sake of “accumulated stress along di identified faults and released seismic energy”.

“Di intensities of di tremors dey weak to light, ranging from III-IV for di Modified Mercalli Scale, and e pose very low-level threat. We dey advise di residents of Mpape, Katampe, Maitama, and oda areas wia dem feel di tremors make dem no panic becos di tremors dey low,” dem tok.

Also, di Minister for Science and Technology, Geoffrey Nnaji, hold emergency press briefing on Wednesday wia e assure di pipo wey live for Abuja say goment go soon put measures in place to check di frequent earth tremors.

“Goment dey currently process and analyse comprehensive datasets from our Seismological and GNSS stations to provide ogbonge recommendations to di FCT Administration.

“We dey ask di residents of Mpape, and di wider Abuja area, to remain calm and continue dia normal activities.”

Some residents for Mpape and Gishiri areas bin tell tori pipo how fear catch dem as ground begin shake and dem fear say dia house fit collapse. Some of dem even say small small cracks don appear for dia walls.

Map showing wia earth tremors happen for Abuja in 2018

BBC
Serious earth tremor bin don happen for Abuja in 2018

Earth tremors for di rocky terrains of di FCT no be new tin, but e never get time wen e dey very serious.

For 2018, BBC Pidgin bin report how earth tremors bin put fear for pipo body, but di Federal Emergency Management Agency (Fema) later calm pipo down.

Also in Ghana, earth tremors bin worry pipo in 2020, affecting areas like Kasoa, Bubuashie, Dansoman, McCarthy Hill, Bortianor, Weija Tetegu, Gbawe, Aplaku, Sowutuom, Awoshie, and Adenta, for inside di capital Accra.

Earthquakes no dey too happen for Nigeria sake of say di kontri no dey located within di major seismic zones.

Wetin be earth tremor?

Earthquake Tremor na wen ground begin shake because of some kain movement and release of energy inside di ground.

Stress inside rocks underground from activity like mineral mining na one major cause.

Tremor fit also mean small earthquake.

Wetin to do if earth tremor start

According to di Federal Emergency Management Agency, Fema, di following na steps to take in case earth tremor start:

  • Calm down and no panic
  • If you dey inside building, find room wey dey safe, bend down and take cover under table or desk and hold am tight.
  • Make sure say you no dey near window or tins wey fit fall on top you
  • If you dey outside, find open area wey tall building, trees and electric poles no dey
  • If you dey inside inside car, slow down and drive go wia open ground plenti and stay dia until di shake shake stop

Source