Toke Makinwa: AMCON react to tori say dem ‘seize’ di Nigerian celebrity Banana Island house

Di Asset Management Corporation of Nigeria don react to tori wey dey fly upandan say dem seize one house for Banana Island wey belong to Nigerian celebrity, Toke Makinwa.

Di spokesperson of Amcon, Jude Uwauzor tell BBC Pidgin say:

“You know say Pan Ocean dey indebted to Amcon? Amcon actually take ova some assets of Pan Ocean group ova di debt of N240bn in a bit to recover our money.”

Oga Uwauzor say im no dey aware if dis particular house wey Toke dey live dey among di one wey Amcon take ova.

E say most of di assets wey dem take ova dey guided by court orders and no be just ordinary take ova.

“So wen court judgement dey ground and Amcon enforce di judgement, e no get anytin wey anybody fit do, na either dem pay and then dem fit re-go court.”

Di spokesperson add say wen Amcon take ova any property, dem dey actually look for buyers, sell di property and then recover dia money.

Wetin Toke tok?

‘Toke still dey stay for her house wey dey Ikoyi and e get something wey plenti pipo dey get wrong, her house no even dey for Banana Island.’

Dis na wetin one of Toke Makinwa managers tok wen BBC Pidgin call to confam if na true say Asset Management Corporation of Nigeria (Amcon) don seize her house.

Recently, Some Fans of di TV/Radio personality spread rumour for Twitter say Amcon don seize di house wey di Chairman of Pan Ocean Oil Corporation (one oil and gas company) but her manager say;

“No be true oh, none of Toke house dey part of di properties wey Amcon repossess and non di properties get anything to do with Toke.”

“A lot of rumour dey come out about her every single moment and we cannot continue to dey address every single one.”

On Monday, Toke tweet say “We Move” as tori begin fly upandan for socia media.

Asset Management Corporation of Nigeria (Amcon) na di Nigerian office wey dem establish by Act of di National Assembly of Nigeria for July 2010 wit a plan say e go stay for 10 years lifespan.

See as Nigerians bin react

Toke Makinwa however pas some coded message for retweets

Toke Makinwa na controversial Nigerian celeb and di last time wen she trend na just days ago wen she tok say Marriage get expiry date.

Na on 3 November, 1984, dem born Toke Makinwa and apart from being a Nigerian radio personality, she also be television host, vlogger and lifestyle entrepreneur.

She dey popular for hosting The Morning Drive on Rhythm 93.7 FM and for her YouTube vlog series Toke Moments.

Toke Makinwa: “Money no dey for dis job o, but you go get exposure”
The British Broadcasting Corporation