Police suspect IPOB/ESN members for di killing of Labour Party Senatorial candidate, five odas for Enugu

Gunmen don kill Labour Party senatorial candidate for Enugu East Senatorial District, Oyibo Chukwu.

Di incident happun on Wednesday wen im dey return from one campaign rally for di southern state of Enugu.

Di attackers burn di late Oyibo Chukwu bodi afta dem shoot am dead.

Di gunmen also kill five supporters wey bin dey inside car wit Oyibo Chukwu.

Death of Oyibo Chukwu of di Labour Party happun three days bifo Saturday general elections wey dey described as di kontri most competitive polls inside 24 years.

Police suspect IPOB/ESN members

Di Commissioner of Police, Enugu State Command, CP Ahmed Ammani, fdc, inside statement say dem don order di intensification of di discreet investigations and manhunt of di criminal elements wey dem suspect to be IPOB/ESN members.

Police say dis jaguda pipo, on di night of 22 February, 2023 for different locations at di same time, ambush, simultaneously attack and kill members of People’s Democratic Party (PDP) and Labour Party (LP) members

Dem also attempt to attack di convoy of di All Progressive Congress (APC) Governorship Candidate.

Di Commissioner vow to make sure say dem fish out di perpetrators and dem go make dem face di full wrath of di law.

How di attacks happun

Police say dia preliminary investigations into di incidents show say di armed hoodlums, wey dey operate wit one tricycle, bin attack one PDP campaign Mini Bus for Topland by Ebony Paint Road, Amechi-Awkunanaw Enugu and use petrol bomb to set am ablaze.

Tori be say dem burn di driver wey dem simply identify as one KC Great to death.

For di same fashion, anoda set of di same armed assailants, wey dey operate for one Hilux motor, attack and set di campaign motor of di Labour Party on fire, for Eke-Otu Amechi-Awkunanaw Enugu

Dem burn di Party Senatorial Candidate for Enugu East Senatorial District, Barr. Oyibo Chukwu wit im Personal Assistant wey dey wit am for di motor to death for di attack.

Security operatives later repel di jaguda pipo as dem dey also attempt to also attack di convoy of di Governorship Candidate of di All Progressive Congress (APC) for Eke, Agbani, Nkanu West LGA.

‘Labour Party members na targets’

Labour Party govnorship candidate for di state, Chijioke Edeoga bin comment say dia party members don become target.

“Our party members dey targeted for assassination by political parties wey dey feel threatened by di rise of di Labour Party for di state and dey fear say dem fit lose di Saturday election”, Chijioke Edeoga tok.

Chijoke Ogbodo, pesin wey dey close to Oyibo Chukwu say e get di informate afta di incident happun.

E say im oga bin go attend some meeting for Agboani for Nkanu-West Local goment council wen dem attack am.

“Im bin go meeting and on im way back one car double cross am and shoot am dead. I also hear say dem kill di driver too. Na wetin I fit confam be dis but oda pipo more pipo die.

“Di saddest part of dis tori na say afta killig dem, di gunmen burn dem and dia car.

“Di tin be say di attack no be mistake becos Oyibo no dey inside branded vehicle. So wetin happun be say dem dey trace dem from wia dem dey come from,” e tok.

Peter Obi condemn killing

Di Labour Party presidential candidate Peter Obi condemn di killing of Oyibo Chukwu.

For im social media handle, Peter Obi say im bin receive di news of di painful killing of Barr Oyibo Chukwu, di Senatorial Candidate of di Labour Party, for Enugu East Senatorial Zonewit deep shock and sadness.

“Enough of di killings, now na time for healing. I sincerely pity di bereaved family, di Enugu East Senatorial Zone and our dear Labour Party family, for dis painful loss,” Obi tok.

Wetin to know about Oyibo Chukwu

Oyibo Chukwu na politician wey come from Enugu state, Southeast Nigeria.

Im na 63 years old.

Im early education na from Abakaliki.

Afta, e gbab university degree from di University of Nigeria, Nsukka for di 80s.

E also attend di Nigeria Law School, Lagos for 1984.

Oga Oyibo Chukwu get plenti work experience.

  • 1999-2000: Acting National Auditor, All Peoples Party (APP)
  • 2011 till date: Chairman, Displinary Committee, Nigeria Bar Association (NBA), Oji River Branch
  • 2009 – 2011: Assistant National Legal Adviser, Ohaneze Ndi Igbo
  • 1990 till date: CEO, KANVOC Nigeria Limited
  • 1994 – 1996: Local Government Administrator/Supervisor for Health, Nkanu LGA
  • 1989 till date: Senior Partner, Chukwu, Chukwu and Associates
  • 1985/1988: Head of Chambers, Chimezie Ikeazor (SAN) and Associates
  • 1984 – 1985: Legal Adviser and Administrative Officer, Anilogun Nigeria Limited
  • 1990 -1993: State Auditor, Social Democratic Party (SDP)
  • 1992: Gubernatorial Aspirant, SDP Enugu State
  • 1993: Acting State Chairman, SDP Enugu State
  • 1993: Presidential Candidate, SDP
  • 1998: Gubernatorial Candidate for Congress for National Concensus (CNC)