Explosion rock Katsina: Improvised explosive device wey be like bomb kill pipo for Malumfashi town in Nigeria

Police for Katsina state Nigeria don begin investigate di explosion wey happun today for Yammama village inside Malumfashi Local Government Area of di state.

Police tok-tok pesin inside di state, Gambo Isah tell BBC Pidgin say five young children na im die and six oda pikin injure.

“For around about 11:30hrs, DPO of Malumfash report say dem hear one loud sound inside di farm of one Alaji Hussaini Mai Kwai.”

“Di explosion kill five young children of one pesin by name Alaji Adamu of Yammama village, Malumfashi LGA of Katsina state.”

“E also injure six oda children wey bin sit under tree inside di farm wey di explosion for happun.”

Oga Gambo Isah say di children bin go di farm to go cut grass for animal feeds and eventually dem come across wetin dem dey call unexplosive ordnance (EOD). e say dis tin fit be grenade or something wey dey explode.

“Di children dey careless because dem neva see dat kind tin before and dem begin dey try to know wetin e be.”

Di police tok-tok pesin say dem don rush di pipo wey injure go Malumfashi hospital for treatment while dia EOD and detective from di criminal department already dey ground to find out di circumstances behind di exxplosion

Katsina na President Muhammadu Buhari home state wey dey northwest Nigeria.