Wetin Falana tok say go happun if VDM no offer ‘acceptable apology’ to im and im son

Famous Nigeria Human rights lawyer, Femi Falana, SAN say im and im son go initiate civil proceedings for di High Court against Very Dark Man if e no retract or tender apology wey dey acceptable to dem.

Di senior lawyer wey tok dis one for one interview wit Channels TV tok say, dis na to restore im and im son integrity, so dat nobody go just rush go social media to defame any Nigerian.

E add say dem wan make example wit dis case.

Dis go be di first time Oga Falana go react afta di whole saga wey follow one viral video wey Martins Otse wey pipo sabi well-well as Very Dark Man drop for social media.

For di video wia e play one audio recording, one voice wey be like popular cross-dresser Idris Okuneye wey pipo sabi as Bobrisky allege say dem go give di lawyer N10m in exchange for presidential pardon.

To debunk di allegations, di Human Rights lawyer tok say, “Bobrisky no ever follow me tok, we no ever meet, I no sabi am from Adam.”

“We don ask for a retraction plus make e tender apology to us and dat no dey too much. And if we no get retraction and apology wey dey acceptable to us, we certainly go initiate civil proceedings for di high court,” e tok.

How di mata take happun

On Wednesday, 25 September, social media influencer Martins Otse popularly known as Very Dark Man or VDM bin release one audio recording of pesin wey e allege say na Bobrisky on social media, wey bin dey say im pay bribe of 15 million naira ($9000) for di authorities of Nigeria corruption joinbodi, di Economic and Financial Crimes Commission, EFFC to drop charges against am.

Di pesin also say e stay for private apartment instead of prison. E bin dey refer to di mata of how dem sentence Bobrisky to six months imprisonment for crimes of naira abuse.

Di voice also allege say Folarin Falana aka Falz bin contact di crossdresser say im papa, Femi Falana (SAN), fit help am apply for presidential pardon and e go cost N10 million.

For di video, Very Dark Man say im go dey disappointed if truly Falz and im papa dey involved for di issue.

Bobrisky don deny di audio recording say no be im voice and say im serve im full term for jail.

Falz and Mr Falana (SAN) also for different statements from dia lawyers, Falana and Falana’s Chambers deny di accuse and Falz ask VeryDarkMan to withdraw di defamatory statement against am.

Investigation bin immediately start afta di audio leak, as di minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo set up committee wey go torchlight di mata. On top di case, di ministry tok say some senior prison officers don dey suspended to allow for investigation.

Di House of Representatives also dey investigate di allegations. Di lawmakers bin recently invite VDM, Bobrisky and EFCC for dia chambers to torchlight di mata.

Di Falanas don sama VDM wit lawsuit, dem say make e retract im statement and apologise.

Afta e receive di lawsuit, VDM bin tok say im no defame di Falanas but only bring di audio recording to public bicos im want make relevant agencies investigate di statement Bobrisky allegedly make.

Also, wen e appear before di House of Reps, e bin share one post on im Instagram page to Falz.

“@falzthebahdguy if you see di nonsense wey dey go on here you go drop lawsuit make we focus on di bad eggs wey wan kpai our kontri, dem dey cast themselves here? Don’t get it twisted your father na my father in di struggle,,, if you dey here you go understand, I no go defame baba FF Bless up, MAN TO MAN GOD BLESS YOU.”

Femi Falana insist on “acceptable apology” as e clear how di mata take involve am and im son, Falz

Afta VDM don come out to say im no fit defame Falana SAN, as e see am as pesin wey don tey for di struggle for a beta Nigeria, di lawyer don tok for di first time afta di mata go viral.

E say im no ever follow Bobrisky tok, however, Bobrisky call im son and beg for assistance. E say dis no be di first time, im children go refer to am cases of pipo wey no fit afford to pay for dia services, and im and im wife bin recently tell dem say, dem go begin dey charge.

“Yes, my son say dis guy dey beg pipo for assistance and e call my son I think on May 4 dis year – please you fit give me N3 million so dat dem go put me for special part of di prison, we call am di VIP section.

“My son ask am, na under di authorization of di superintendent of prisons you take dey call me? E say no – please no call me again, I no fit help you bribe di prison authorities and dey very careful since you don already dey for prison for one offence.

“Please if you go call me next time, you either do am through di superintendent or you write a letter wey di prison authorities endorse and dat na di last. Somebody now start releasing tapes somewhere and go on to lampoon and rather defame me by saying di guy follow me tok.”

Di SAN, wey label di allegation “infantile radicalism”, say im don assist 280 convicted pipo both home and abroad to get pardon and never on any occasion im or im law firm don demand for or receive a dime from anybody granted pardon.

E say im bin resist di temptation to file criminal complaint becos im dey lead one team of lawyers for West Africa and dem dey campaign for decriminalisation of freedom of expression.

He, however, say dat no be licence for defaming and blackmailing pipo, e add say dem go embark on civil proceedings and dat na to restore im integrity plus dat of im son.

Oga Falana say dem go use dis case set example so dat nobody go simply run go social media to defame any Nigerian.

VDM for im response to Femi Falana (SAN) tok say di mata no be about im or di Falanas but to expose di corruption wey dey for di kontri.

“Uncle Falana na pesin wey I respect and even if e carry me go court and I go jail, I go still lie down flat wen I see am,” e add.

Source