Oda times failure of dams don cause flood disaster for Nigeria

Flood in Borno state Nigeria, 2024

BBC

Nigerian authorities don confam say di flooding wey happun for Borno state don kpai 37 pipo.

Na di oga of di national emergency management agency (Nema) wey dem dey call Zubaida Umar tell BBC dis one.

E add say almost 500,000 pipo don run comot for house sake of dis flood and di number go fit rise as many pipo still hook for dia house.

For di state capital, Maiduguri, about 40% of di city don dey damaged by di floods.

Di floods scata hospitals, zoos and farms among oda places.

Na di worst flooding wey di city don se in di last thirty years.

Dis na as authorities don arrange eight IDP camps for Maiduguri for pipo wey dey affected and search and rescue efforts still dey go on.

Dis dey happun as Nigeria economy dey face serious inflation wey high well-well and many communities dey struggle to cope.

Oil subsidy removal wey di pipo dey use hold body don make cost of living go up.

Many families dey struggle – wey make pipo enta street protest “End bad governance” last month.

But wetin bin cause dis flooding for di Northeastern state?

Tori be say na di Alau dam wey fail to hold water afta heavy rain bin fall for di state cause di flood.

Dis na according to statement wey di Borno State Ministry of Education, Science, Technology and Innovation bin release.

Na di same tin cause flooding di thirty years ago wey dis kain flooding for di city happun.

But no be di times wey dams don cause flooding wahala for Nigeria.

Ova di last few years from around 2017, flooding don turn ogbonge issue for Nigeria.

Di emergency release of excess water from dams both in Nigeria and in neighbouring Cameroon na anoda key factor wey dey cause harmful flooding.

And quite a number of dem na sake of flooded dams, so we say make we torchlight which dams overflow wey cause around di kontri.

Lagdo Dam, 2022

Around 500 pipo kpai and ova 45,000 houses bin scata for flooding due to do spillage of di Lagdo Dam for Cameroon.

E affect Anambra sotay dem arrange IDP camps for residents wey run comot dia house sake of flood – di flood eventually reach oda states dat time.

E bin also affect Kogi, Adamawa, Nasarawa, Benue, and Taraba states.

Kainji dam, 2020

Nema bin report say Niger state bin see di worst of di flooding wey happun for 2020 as tori be say 150 communities bin dey under water.

Niger state govnor Abubakar Sani Bello bin blame di mata on di opening of di spillway Gates for dia Kainji dam join wit di spillage of di Shiroro and Jebba sama join, according to how Daily Trust bin quote am say im tok.

Di flooding no only kill unconfirmed number of pipo but e also scata farmlands and also spoil 80 billion naira investment.

Zungeru dam, 2018

At least 40 pipo die and hundreds lose dia houses inside 100 communities for Niger state, north central Nigeria

One of di villages wey face dis flood, Gundu bin face am for di first time or 2018 afta federal goment begin to build di tear rubber Zungeru dam inside Niger state.

Lagdo dam, 2012

NASA reveal say di release of di Lagdo dam for Cameroon bin cause d death of about 30 pipo for Nigeria.

Dis na becos wen dem release am for dia side wen water don fill di damn too much e dey make di River Benue to swell.

Nigeria meteorological agency don warn flooding fit happun for some oda part of di kontri sake of rain wey dey come.

Source