BRT bus kidnap: Police arrest BRT bus driver over death of Ayanwole Oluwabamise

Police don arrest di BRT driver wey carry 22-year-old Oluwabamise Ayanwole.

Na Adekunle Ajisebutu, tok-tok pesin for di Lagos state Police Command confam dis one to tori pipo.

Di command bin confam di death of Bamise for earlier statement.

According to di police, “We see di deadi bodi dey lie on top Carter Bridge by Ogogoro Community, Lagos Lagos Island. Di corpse dey for morgue for Mainland Hospital, Yaba, for autopsy.”

Tori be say di driver of di Lagos state Bus Rapid Transit System allegedly kidnap Oluwabamise Ayanwole.

How e allegedly happun

According to di police, di incident allegedly happun on 26 February, 2022 wen Ayanwole board di BRT bus from Chevron bus stop, Lekki for Lagos, South West Nigeria. Di BRT bin dey go Oshodi around 7:00pm in di evening.

Dem never see her till today.

Di young lady wey be fashion designer also do video wit her friend wen she sense say some tin wan happun to her.

For di video wey she do wia she speak Yoruba she say, “na three men and one woman dey inside di bus. Di woman sidon for back.”

Zooming-in di phone camera she say “dat na di number of di bus just in case. Please pray for me.”

Still for di video di friend wey she tok to advise am to come down for Oworonshoki but nobody know wetin happun afta dat time.

Police begin investigation

Kunle Ajisebutu, tok-tok pesin for di Nigerian police say di family don report di case to di command.

E tell BBC Pidgin for interview say police don already arrest di guarantor of di driver – “na only am fit lead us to di driver”.

Police later release statement say dem don arrest two suspects for di mata.

E say di Commissioner of Police dey ginger di investigation and “very soon we go get wetin to tell una.”

Di Police tok-tok pesin add say dem dey careful about di kain informate wey dem dey give make e no affect dia work.

Cases of kidnapping don increase

Cases of kidnap don dey on di rise for di kontri and security agencies don make many arrests recently.

Recently three boys for Ogun State chop arrest after dem allegedly kill dia friend girlfriend for money ritual.

Di three boys include two teenagers and anoda wey dey 20 years.

Dis no follow for di plenty report of kidnapping wey dey happun often for different part of di kontri.