‘I bin tink say me and my children go die’ – Sad tori of victims of Maiduguri flood disaster

A man leads two women to safety from di flood waters

BBC
Pipo wey don die for dis recent flood disaster for Maiduguri don pass 37, according to official figures by Nema

Fatima Yakubu finally reach di Internally Displaced Peoples (IDP) camp on Wednesday afta flood bin enta her house for night.

Di 26-year-old mother and her children sleep for road wit plenty oda families wey also dey affected by di flood.

She tell BBC say na God grace save her and her family life.

“I dey live close to di dam. Na around 1 am I wake up wen I feel water for my legs. Di water just dey rise very fast. Fear bin catch me,” she tok.

“I bin tink say I go die wit my children, but some men hear as I dey shout and dem come rescue us.

“Even though I no fit save any of my property, I dey tank God say at least we still dey alive.”

Officers and men of di Nigeria armed forces also join di rescue efforts, as dem put on hold dia counter-insurgency operations briefly to face di more urgent disaster.

According to di National Emergency Management Agency (Nema), more dan 70 percent of Maiduguri, di capital city of Borno State for di south east region of Nigeria, don dey submerged by flood. Di damage to goods and property go dey run into billions of naira.

Di flooding na sake of di Alau Dam – di major water reservoir for di city – wey burst sake of heavy rains.

Plenty foto for social media show how pipo climb rooftops and trees to take shelter.

Pipo dey struggle for food relief items for one IDP camp for Maiduguri

BBC
Pipo dey rush for di available food relief items for di IDP camps wey mean say sick pipo and nursing mothers fit dey go hungry

Both di Federal and State goments don open new IDP camps for di pipo flood pursue comot from dia homes, but food supplies no dey enough.

“Pipo dey always rush for food hia and me wey be nursing mother, I no get strength to rush wit dem,” Fatima tok.

“My children bin share only one plate of food today. Na one woman wey follow us dey for dis camp give me di food so I sacrifice am for my children. Dem still dey hungre while me I neva even chop anything.”

BBC tori pipo witness how di govnor of Borno State, Babagana Zulum follow for di emergency team wey dey give out relief materials to pipo for Maidugurin dis Thursday morning.

Plenty pipo stand for inside di water raising dia hands to di trucks wey dey distribute food.

Fear of disease outbreak

Pipo inside flood water for Maiduguri

BBC
Di United Nations Office for Humanitarian Affairs say ground water don dey contaminated and disease fit start to dey spread

Di United Nations don express concern over possible outbreak of cholera and oda diseases for di IDP camps wey goment open for Maiduguri.

For inside one statement, di United Nations Office for Humanitarian Affairs (OCHA), tok say wetin pipo need now na food, shelter and clean drinking water.

However, di announcement tok say di drinking water don dey contaminated and e fit cause vomiting and diarrhoea wey be signs of cholera.

“Lack of clean drinking water na threat to children, di elderly and pipo wey get special needs,” di UN agency tok.

Already, Nigeria bin don dey battle wit a national cholera outbreak wey don kill about 204 pipo for across di kontri dis 2024, according to di National Centre for Disease Control (NCDC).

Double wahala for Borno State

Dis flood disaster na double wahala for Borno State wey be di major hotbed for di Boko Haram insurgency for Nigeria, wey don kpai thousands of pipo and pursue ova two million odas comot for dia homes.

Plenty areas for di state still dey too dangerous to go to witout beta military escort, as di Islamist group continue to dey carry out attacks periodically for di state and nearby areas.

Wit dis recent development, fears of insecurity go also rise becos, according to officials of di Nigeria Correctional Services, more dan 280 prisoners don escape from di Maiduguri medium security custodial centre sake of di flooding wey also affect di facility.

Di rising water also enta for di Sanda Kyarimi Park for Maiduguri wey be zoo wia some animals like ostrich, crocodiles and snakes dey. Goment don already issue alerts make pipo dey careful becos tori be say some of dis animals don escape from di zoo.

Dis na di worst flooding disaster for Borno State since 1994, according to officials of di state. And for 1999, na di same bursting of di Alau Dam.

Woman stretches hand towards a food relief truck in Maiduguri

BBC
Pipo dey rush for di available food relief items for IDP camp wey mean say sick pipo and nursing mothers fit dey go hungry

Source