Why Kaduna state lawmakers want make dem investigate El-Rufai goment

Kaduna State House of Assembly don approve make dem investigate former Govnor Nasir El-Rufai goment sake of allegations say dem mismanage some part of di money wey im borrow wey reach more dan $758 million during im tenure.

Di investigative committee on former Kaduna State Govnor El-Rufai, wey Kaduna State House of Assembly set up, present dia findings to di house on Wednesday.

Dis one follow as di committee chairman, Magaji Henry Danjuma, as e dey present di investigation results to di house today, tok say dem find evidence of mismanagement and misappropriation of di money wey El-Rufai goment borrow.

Di committee report tok say di money wey former Kaduna State Govnor Nasiru El-Rufai borrow wey reach more dan $758 million, dem no use am all for di projects wey di former goment tok say dem do.

Explaining why dem do di investigation to BBC Pidgin, di committee chairman, Barrister Magaji, say, “Govnor Uba Sani na im start dey complain about di financial wahala wey di state dey face sake of di plenty debt wey di state don carry.”

“Dis one make us set up di investigative committee wia we discover say Kaduna state borrow more dan $758 million wit di promise say dem go do projects for di state. But our investigation show say dem no use all di money for di projects wey di former goment do from 2015 to 2023,” im tok.

E add say, “Dis debt don make di state goment no fit pay workers salary well becos of di deductions from di state money every month.”

Di Kaduna State House of Assembly set up dis committee after Govnor Uba Sani complain about di state inability to pay workers salary sake of di deductions from dia funds from N10 billion to N3.4 billion.

Inside statement through im tok-tok pesin, Muyiwa Adekeye, di former govnor say im lead a government of integrity and competence during im eight-year administration.

E say, “Malam Nasir El-Rufai dey very proud of im record of governance and di legacy e leave for Kaduna State. Dis record of consistently high performance in public and private office no fit dey changed by any malicious effort to use di state legislature for defamation and undeserved smears.

“Many of di officials wey serve for di El-Rufai government appear before di ad-hoc committee because of dia confidence in di quality of dia service for Kaduna State. Dem bin no reason say dem dey participate in a fair process.” Part of di statement read.

“Malam El-Rufai wish to assure discerning Nigerians say e serve Kaduna State with integrity and to di best of im capacity, assisted by a hardworking and patriotic team. E comply with all laws in all im activities while e be di govnor. Dis probe suppose dey disregarded as di politically motivated hatchet job wey e be.” Di statement further tok.

Source