‘Those wey dethrone me…’ – Muhammadu Sanusi II send message to Ganduje, odas afta im reinstatement as Emir of Kano

Kano state govnor Abba Yusuf present letter of reinstatement give Emir Muhammadu Sanusi II for di Kano state government House

BBC
Kano state govnor Abba Yusuf present letter of reinstatement give Emir Muhammadu Sanusi II for di Kano state government House

Dem don reinstate Sanusi Muhammadu as Emir of Kano afta e receive im letter of appointment from Governor Abba Yusuf on Friday.

Kano state govnor Abba Yusuf present am wit im letter of appointment for di state government house, Kano on Friday, 24 March.

Im reinstatement dey come four years afta di immediate-past govnor of di state Abdullahi Ganduje remove am.

Traditional rulers, kingmakers plus oda top dignitaries bin attend di event wey happun barely one day afta govnor Yusuf sign di Kano State Emirate Council (Repeal) Bill 2024 into law.

Muhammaudu Sanusi reinstatement as Emir of Kano Emirate happun despite one court ruling wey stop am.

On Thursday, one Federal High Court for Kano bin issue one order to stop Kano state government from reinstating Emir Muhammadu Sanusi II.

Di court also pause di implementation of di new law wey cancel di four emirates of Bichi, Gaya, Karaye, and Rano.

Justice Mohammed Liman order say make all di parties wey dey involved maintain status quo pending di determination of one suit wey di Sarkin Dawaki Babba, Aminu Babba-Dan Agundi file.

Di suit dey challenge di recent actions wey Kano State government.

Di new emir go lead di Friday prayer for di state government house mosque no be di south gate mosque wey dem earlier plan.

Emir Sanusi Lamido Sanusi di 16th thank God for im role to bring back im position as Emir of Kano.

Im tok say di time wey dey divide di emirate in to five dey like dey wan divide di unity of Kano pipo.

Mohammad Sanusi II tok say if Abba no bring am and di emirate back into one, di future rotation of Kano Emirs for don get scatter.

E commend di “wisdom and will” of govnor Abba to safeguard di history of Kano state.

“Those wey depose me as Emir of Kano] no dey worthy of my reply” Sanusi Lamido Sanusi tok during im speech for goment house.

Kano govnor respond to di court order wey halt Sanusi reinstatement

Kano state goment reinstate Sanusi as Emir of Kano

BBC

During di reinstatement ceremony of Sanusi, govnor Yusuf tok say dem follow all do necessary rules in cancelling di state monarch law.

For one speech e deliver as e dey hand over di letter give di new emir, e say dem noi dey fear anybody.

E add say di 2019 law wey see to di removal of Sanusi na case of victimisation. E narrate di events wey lead to im reinstallation as emir.

“We bin get series of meetings wit di Kingmakers yesterday, extensive discussions wit di Speaker, and we also sit wit all di heads of security. At di end of di day, all of us gada for di chamber where I receive di bill wey repeal di former law, and we sign di new law wey repeal di appointments oda emirs,” di govnor tok.

Muhammadu Sanusi II reinstated as Emir Of Kano

ano state goment reinstate Sanusi as Emir of Kano

BBC

Four years afta former Kano state govnor, Abdullahi Ganduje remove Muhammadu Sanusi Lamido II as di Emir of Kano, di current govnor Abba Yusuf don reinstate am back to di throne.

“Wit di full support of di kingmakers, I don approve di reappointment of Mallam Sanusi Lamido,” di govnor tok for di Art Chamber of di Kano State Government House around 5:16 pm on Thursday as pipo rejoice.

Emir Sanusi II, na former governor of di Central Bank of Nigeria, wey pipo dey call Lamido Sanusi before e become king.

Governor Yusuf reinstate am afta e sign di Kano State Emirate Council (Repeal) Bill 2024 into law.

Di new law don replace di Kano State Emirates Council Law, 2019 and e dissolve di emirate councils wey govnor Yusuf predecessor, Abdullahi Ganduje create.

Ganduje bin use dat law to split di Kano Emirate into five for December 2019 and remove di 14th Emir of Kano, Muhammadu Sanusi II, on March 9, 2020.

Di emirates wey Ganduje administration create na Karaye, Bichi, Rano, and Gaya, in addition to Kano.

Di decision bin generate plenty controversy dat time and govnor Yusuf, wey reverse am tok say di old law bin scata ova 1,000-year-old law of di Kano Emirate.

Based on di new law, di govnor don give di emirs wey rule di dissolved emirates 48 hours to vacate dia palaces.

“From di very moment I sign di bill into law, e mean say all appointments made in accordance wit dat 2019 law don become void, and di balkanised Kano Emirate don dey restored to its original pre-2019 status,” e tok.

“Di repeal of di 2019 law mean say no oda emir dey for Kano as of now except di reinstated emir.”

Who be Emir Muhammadu Sanusi II?

Alhaji Muhammadu Sanusi II

Getty Images
Reinstated 16th Emir of Kano Emirate Alhaji Muhammadu Sanusi II

Muhammad Sanusi II become di 14th Fulani Emir of Kano on 8 June, 2014, wen Rabiu Kwankwaso be govnor of Kano State.

E dey appointed as emir less dan four months afta Goodluck Jonathan, wey be president at di time, remove am as di govnor of Central Bank of Nigeria on top say e accuse Jonathan-led administration of corruption five years into im tenure as di CBN govnor.

Similar scenario go play out during im reign as emir for Kano under di administration of Ganduje.

For 2017, govnor Ganduje and Sanusi II bin disagree sake of wetin e tok about how di state government take dey handle di state finances according to reports.

Sanusi bin accuse di government of mismanagement and corruption, particularly on top di state debts.

Di disagreement between di two of dem escalate for 2019, wey make di Kano State government create four additional emirates, thereby reducing di powers of di emir.

Sanusi challenge di creation of di emirates for court, as e argue say e dey politically motivated and di govnor design am to weaken im position as emir.

However, for March 2020, one Kano State High Court rule say di emirate councils di goment create dey legal.

For March of di same year, di Kano state government remove Sanusi from im position as Emir of Kano, on top accuse of insubordination and disrespect to di governor plus oda officials.

E also dey accused of corruption and dem carry out investigation. Sanusi deny di allegations and challenge im removal for court, but im efforts bin dey unsuccessful.

Dem replace am wit Aminu Ado Bayero, di son of im predecessor, Emir Ado Bayero, wey erign as Emir of Kano from 1963 to 2014.

Dem born Muhammadu Sanusi II for July 31, 1961 to Muhammad Aminu Sanusi and Saudatu Anduwa Hussain.

E be di grandson of King Sanusi wey dem remove from di throne.

E get degree for di field of design and economy and for di field of Islamic religion.

Dem appoint am CBN govnor for June 2009.

Fotos from di reinstatement of Muhammadu Sanusi II as Emir of Kano

ano state goment reinstate Sanusi as Emir of Kano

BBC
ano state goment reinstate Sanusi as Emir of Kano

BBC

Source