How Uganda plan to bury Olympian wey her ex-boyfriend kill

Ugandan Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei

EPA

Ugandan Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei, wey her former boyfriend burn wey later die, go get state burial on Saturday.

Dickson Ndiema attack am wit fuel less dan two weeks ago outside her house for north-west Kenya near wia she dey train.

Di way di 33-year-old killing happun make her family sad and shock odas from around di world.

E torchlight di high level of violence against women for Kenya and also torchlight say plenti female athletes don turn victims in recent years.

Cheptegei go get full military honours for her burial sake of say, she bin dey work as member of di Ugandan armed forces.

Meanwhile, Rebecca Cheptegei home district, Bukwo in eastern Uganda, don honour di late athlete by moving a motion to name one road and a sports venue after her.

Local leaders bin organise memorial to remember di late marathoner.

Councillors from Bukwo district for Mount Elgon region say Cheptegei live “a simple and focused life” and bin always dey offer guidance to her fellow athletes. “She inspire many children in di area to join athletics,” dem tok during di memorial service ahead of her burial.

During di session wey happun for Bukwo district hall, di councillors observe a moment of silence and give standing ovation as dem pay respect to di late athlete. Di military band play di Ugandan and East African anthems.

Ugandan Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei mama dey cry afta her death

Getty Images
Ugandan Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei mama dey cry afta her death

Cheptegei bin die for hospital four days afta di attack. Doctors say she suffer burns for 80% of her bodi wey “cause multiple-organ failure”.

Ndiema, wey follow burn as fuel touch im own bodi during di attack, also die on Monday.

E attack di mama of two wen she dey come from church, for di God’s Dwelling Ministry.

Di pastor for dia remember Cheptegei say she be “wonderful… God-fearing pesin”.

Afta she hear wetin happun, she manage follow Cheptegei tok for phone wen di runner still dey hospital.

Di pastor tell BBC Africa Daily podcast say she first ask about her pikin dem, wey dey fine, bifor Cheptegei start to dey enta her attacker mata: “You mean say Dickson no fit see wetin I don do for am? E no fit remember one or two wey I don do for am and no set me on fire? Why e do dis kain tin to me?”

On Friday, family, friends and activists against gender-based families bin go look her coffin for di funeral home for di Kenyan town of Eldoret bifor dem carry am go.

Her mama, Agnes Ceptegei cover her face, as she dey cry, as she carry one souvenir bag wey di athlete bin collect for di recent Paris Olympics, wia she come 44th for marathon.

Di mama wear t-shirt wia dem write “being a woman no suppose be death sentence”.

Cheptegei, di marathon runner na di third female athlete wey dem go kill for Kenya in di last three years.

For each of di case, na former or present lovers na im di police don name as main suspects.

For 2021, dem stab world record holder, Agnes Tirop to death and six months later, dem strangle Damaris Mutua.

Rebecca Cheptegei as she dey run for di World Athletics Championships Budapest 2023 on August 26, 2023

Getty Images

Attacks on women don turn major gbege for Kenya. For 2022, at least 34% of women say dem don face physical violence, na wetin one national survey tok.

Some observers tok say female athletes don dey turn target more and more.

Joan Chelimo wey join start Tirop’s Angels to torchlight violence against women tok say di reason na “bicos dem no dey follow di traditional gender norms wey woman go just dey kitchen, dey cook and take care of pikin. But now, female athletes don dey more independent, wit money sef, dem dey independent”.

Rachel Kamweru wey be tok-tok pesin to di goment department for gender and affirmative action, tell BBC say, “we no want make dis kain tin happun to any oda woman, weda na athlete o, or come from village o, or na small girl”.

Wen Cheptegei start to dey run, she enta di Uganda Peoples Defence forces for 2008 wey follow support am.

Her last race na for Paris Olympic. Even though she carry 44th position come house, pipo for her yard still hail am say she be “champion”.

She bin win gold for di World Mountain and Trail Running Championships for Chiang Mai, Thailand for 2022.

Pictures from Cheptegei burial activities

Hundreds of people including leaders from her home country, Uganda, and neighbouring Kenya, wia Ms. Cheptegei live and train, dey expected to attend di funeral. Di service go happun for di Amanang senior school for di district where dem go give Cheptegei full military honours.

Dem go bury Cheptegei for her father place for Kapkoros.

Source