Meet di Africans for di 2024 Ballon d’Or award

Getty Images

Nigeria and Atalanta striker, Ademola Lookman, dey among di players wey dey nominated for di 2024 men Ballon d’Or award.

Di striker wey be di only male African player make di list afta im fine performance for im club and kontri.

Lookman help Nigeria reach di final of di African cup of Nations wey dem lose 2-1 to Ivory Coast

Im score hattrick for Europa league final to help Atalanta beat Bayern Leverkusen 3-0.

To date, African football icon George Weah na di only African wey dem don vote as di best player for di world afta im win di Ballon d’Or for 1995 ahead of Germany Jurgen Klinsmann and Finland Jari Litman.

For di women category Barbra Banda di captain of Zambia women team na di only African woman for di list.

Ronwen Williams di South African goalkeeper wey dey play for Mamelodi Sundowns make shortlist for di Yashin Trophy.

Aston Villa Emiliano Martinez again name dey too, im win am last year – di award na for di best goalkeeper.

Meanwhile six players wey help England reach di Euro 2024 final dey di 30-man shortlist.

Captain Harry Kane, midfielders Jude Bellingham, Phil Foden and Declan Rice, and forwards Bukayo Saka and Cole Palmer dey eye di ogbonge prize, wey dem dey give di best male footballer for 2024.

Lamine Yamal – Spain and Barcelona winger wey only turned 17 for July – also make di list.

England bin reach di final of Euro 2024 but lose 2-1 for di final to Spain for Berlin on 14 July.

Wen be di 2024 Ballon d’Or awards?

Di 68th edition of di awards ceremony go take place on Monday 28 October for di grandiose Théâtre du Châtelet, for Paris.

No Messi or Ronaldo for di first time since 2003

Argentina and Inter Miami forward Lionel Messi, wey don win di Ballon d’Or winner eight-times and wey win di prize for 2023, no make di list dis time.

Dis na di first time since 2003 wey neither Messi, 37, or five-time winner Cristiano Ronaldo, 39, name appear for di list of nominees.

Wit di only oda previous winners wey still playing and no make di list na – Karim Benzema and Luka Modric.

Di award na by voting by a jury of journalists from each of di top 100 kontris for Fifa men world ranking.

Manchester United duo Kobbie Mainoo and Alejandro Garnacho collect nomination for di Kopa Trophy, wey dem dey award to di best men young player of di year.

Meanwhile, Pep Guardiola name dey for di men coach of di year aft aim win anoda Premier League title wit Manchester City.

Ballon d’Or nominees (men)

Jude Bellingham (England and Real Madrid)

Ruben Dias (Portugal and Manchester City)

Phil Foden (England and Manchester City)

Federico Valverde (Uruguay and Real Madrid)

Emiliano Martinez (Argentina and Aston Villa)

Erling Haaland (Norway and Manchester City)

Nico Williams (Spain and Athletic Bilbao)

Granit Xhaka (Switzerland and Bayer Leverkusen)

Artem Dovbyk (Ukraine and Roma)

Toni Kroos (former Germany and Real Madrid)

Vinicius Jr (Brazil and Real Madrid)

Dani Olmo (Spain and Barcelona)

Florian Wirtz (Germany and Bayer Leverkusen)

Martin Odegaard (Norway and Arsenal)

Mats Hummels (Germany, free agent)

Rodri (Spain and Manchester City)

Harry Kane (England and Bayern Munich)

Declan Rice (England and Arsenal)

Vitinha (Portugal and Paris St-Germain)

Cole Palmer (England and Chelsea)

Dani Carvajal (Spain and Real Madrid)

Lamine Yamal (Spain and Barcelona)

Bukayo Saka (England and Arsenal)

Hakan Calhanoglu (Turkey and Inter Milan)

William Saliba (France and Arsenal)

Kylian Mbappe (France and Real Madrid)

Lautaro Martinez (Argentina and Inter Milan)

Ademola Lookman (Nigeria and Atalanta)

Antonio Rudiger (Germany and Real Madrid)

Alejandro Grimaldo (Spain and Bayer Leverkusen)

Ballon d’Or nominees ( women)

Aitana Bonmati (Spain and Barcelona)

Barbra Banda (Zambia and Orlando Pride)

Tarciane (Brazil and Houston Dash)

Lauren Hemp (England and Manchester City)

Trinity Rodman (United States and Washington Spirit)

Ada Hegerberg (Norway and Lyon)

Manuela Giugliano (Italy and Roma)

Mallory Swanson (United States and Chicago Red Stars)

Glodis Viggosdottir (Iceland and Bayern Munich)

Mariona Caldentey (Spain and Arsenal)

Lauren James (England and Chelsea)

Lea Schuller (Germany and Bayern Munich)

Patricia Guijarro (Spain and Barcelona)

Gabi Portilho (Brazil and Corinthians)

Tabitha Chawinga (Malawi and Lyon)

Caroline Graham Hansen (Norway and Barcelona)

Lindsey Horan (United States and Lyon)

Sjoeke Nusken (Germany and Chelsea)

Yui Hasegawa (Japan and Manchester City)

Lucy Bronze (England and Chelsea)

Salma Paralluelo (Spain and Barcelona)

Giulia Gwinn (Germany and Bayern Munich)

Khadija Shaw (Jamaica and Manchester City)

Grace Geyoro (France and Paris St-Germain)

Alexia Putellas (Spain and Barcelona)

Sophia Smith (United States and Portland Thorns)

Ewa Pajor (Poland and Barcelona)

Alyssa Naeher (United States and Chicago Red Stars)

Mayra Ramirez (Colombia and Chelsea)

Marie-Antoinette Katoto (France and Paris St-Germain)

Yashin Trophy

Diogo Costa (Portugal, Porto)

Gianluigi Donnarumma (Italy, Paris Saint-Germain)

Gregor Kobel (Switzerland, Borussia Dortmund)

Andriy Lunin (Ukraine, Real Madrid)

Mike Maignan (France, Milan)

Giorgi Mamardashvili (Georgia, Valencia)

Emiliano Martínez (Argentina, Aston Villa)

Unai Simón (Spain, Athletic Club)

Yann Sommer (Switzerland, Inter)

Ronwen Williams (South Africa, Mamelodi Sundowns)

Source