How military track, arrest suspected killer of FUNAAB student Christiana

Police don make arrest over di kidnap and murder of one undergraduate for Lagos, Nigeria commercial city.

Di victim na Christiana Idowu – 21-year-old undergraduate of Federal University of Agriculture, Abeokuta (Funaab), Ogun State.

Di suspect wey police don identify allegedly collect ransom from di parents of Idowu Christianah.

Police tok tok pesin for Lagos Benjamin Hundeyin tell BBC News Pidgin say na Nigeria Army carry out di operation and dem go soon hand over di suspect to police for prosecution.

Tori bin comot for August say Christianah dey miss and all efforts to find am neva yield any results.

Christianah bin dey go Unilag from Itaoluwa through Yaba on di day she disappear.

As di tori begin trend more details begin come out. Students Union goment of her school release notice say pipo wey kidnap dia colleague don stop to dey pick calls. Dem call for prayers from fellow students to ensure her release.

One girl wey say she be cousin to Christiana post online say she hear say her cousin don die. She add say she remember wen di victim mother die nine years ago wen di girl still dey 12 years old.

Family sources tell BBC News Pidgin say di suspect kidnap Christianah and reach out to her parents for ransom of three million naira ($18,000) wey her parents negotiate wit am and dem agree to pay 350,000 Naira.

Tori be say dem pay di money to the account of di suspect, but afta di transaction, di suspect stop to dey pick dia calls.

Security operatives use di account number wey di family use make di payment trace di BVN of di suspect. Dem get im two numbers. Dem use di numbers track him to im parents house for Ikorodu area of Lagos.

Wen dem arrest am, dem find di victim phone on am and also find details of di money transation wey relate to di kidnapping incident.

E allegedly confess to di father of di girl and security pipo say im kill di victim and bury her for shallow grave inside im compound.

Further investigation reveal say di victim and di suspect na friends, dem dey attend di same church and be friends for social media.

Source