Police confam abduction of medical and dental students for Benue State

Medical doctors

Getty Images

Police don confam say gunmen kidnap some students from di University of Maiduguri and di University of Jos, for Otukpo area of Benue State.

Benue State police tok-tok pesin Anene Sewuese Catherine tell BBC News Pidgin say di time wey dem report di incident to am na around 7:30pm on Thursday, 15 August.

But she tok say dem neva fit confirm di exact number of students wey dem carry.

BBC News Pidgin still dey reach out to di University of Maiduguri and di University of Jos to react to di situation.

Dis no be di first time wey gunmen go dey kidnap Nigerian students.

On 7 March 2024, gunmen bin ride motorcycles enta LEA Primary and Secondary School, Kuriga, Kaduna State, northwest Nigera, wen di students dey for assembly ground around 8:30am and kidnap di students wey dey between di ages of eight and 15 and teachers.

Dem shoot one girl wey late land for hospital now.

However, di students bin return to dia homes wit one military convoy afta security pipo say dem rescue dem.

“We give tanks to God, we dey happy and we say tank you to evri one wey show concern for Nigeria and around di world,” Muhammad Jibrin, di papa of one of di rescued children tok as e receive im son.

Di students return to dia homes four days afta officials tok say 137 pupils dey rescued from one forest about 200 km to di north of Kaduna for neighbouring Zamfara state following 17 days for captivity.

Meanwhile, di National Association of resident Doctors for University of Port Harcourt Teaching Hospital protest to demand di release of one of dem, Dr. Ganiyat Popoola wey jaguda pipo kidnap seven months ago for Kaduna.

Dem dey call on di federal goment, security agencies and Kaduna State goment to do evritin possible to secure her release as seven months dey too long for her to still dey her kidnappers hands.

Dr. Popoola na registrar for Department of Ophthalmology, National Eye Centre Kaduna, and na on 27 December 2023 jaguda pipo kidnap her along wit her husband, a military officer and her nephew.

Di incident happun for di Staff Quarters of di National Eye Centre Kaduna and dem neva hear anytin about dem since dat time.

Dem add say if afta two weeks dem no hear anytin about her release, dem go go on nationwide strike on 26 August 2024 to drive home dia point.

Source