Samoa Agreement wey Nigeria sign spark controversy – all you need sabi about dis document

Di Samoa Agreement don become talking points for many Nigerians as dem dey wonder wetin e dey about since di tori say Nigeria don sign am bin dey public.

For 15 November 2023, di European Union (EU) and member states bin come togeda to sign one new partnership agreement wey dem refer to as di Samoa Agreement.

Di member states wey dey di agreement na di Organisation of African, Caribbean and Pacific States (OACPS).

Na about 27 member states from di European Union dey di agreement and na up to 79 African, Caribbean and Pacific kontris bin come togeda sake of di agreement.

Di population of pipo from di kontris wey dey di agreement reach more dan 1.5 billion pipo.

Wetin be Samoa Agreement?

According to di OACPS, di Samoa Agreement na about human rights, democracy and good governance wey also include gender equality and di rule of law.

Di Samoa Agreement na to build environment wey go help di economies to survive.

Di European parliament say di Samoa Agreement dey based on six priorities:

‘human rights, democracy and governance; peace and security; human and social development; inclusive, sustainable economic growth and development; environmental sustainability and climate change; and migration and mobility.’

Di agreement dey agreed on for di 46th session of di ACP-EU Council of Ministers wey take place bifor di signing ceremony for Samoa.

Di Samoa Agreement dey expected to help build investment and trade relations, promote development and peace for di regions of member states.

Secretary-General Georges Rebelo Pinto Chikoti of di Organisation of African, Caribbean and Pacific States, say wetin dey di ‘OACPS-EU partnership agreement to find true development and progress for members to collaborate and collective efforts.’

Nigeria don sign di Samoa Agreement?

For 28 June 2024, Nigeria bin join oda member states wey sign di agreement.

Nigeria na part of di Organisation of African, Caribbean, and Pacific States (OACPS) wey be combination of kontris from di region of Africa, Caribbean and di Pacific.

OACPS put di tori for dia X page to confam say Nigeria don sign di Samoa Agreement and dem join oda members states.

“Nigeria today sign di Samoa Agreement to join 72 fellow members. Ambassador Obinna Chiedu Onowu represent im kontri to sign di Samoa Agreement for di OACPS Secretariat for Brussels.”

OACPS add say, “Majority of di 79 OACPS member states bin sign di agreement for Apia, Samoa, on 15 November 2023.”

According to OACPS, di Samoa Agreement dey serve as one policy wey go help di cooperation between di OACPS and di European Union to promote development.

“Di aim na to promote development, fight climate change and di effects, to generate investment opportunities, and collaboration among OACPS member states for di international stage.”

Samoa Agreement concern LGBTQ? Wetin goment tok

One senior special assistant to di president, Temitope Ajayi, tok say di tori wey tok about di agreement to allow same sex agreement by di Nigeria goment sake of $150 billion na tori wey mislead pipo.

Im add say di Media Assistant to Minister of Budget and Economic Planning, Bolaji Adebiyi clear di air say di document wey goment sign na for di development of Nigeria.

“E dey ridiculous and unreasonable to put say di Nigerian goment sign one agreement to allow same sex marriage sake of allege $150billion and no reference to any part of di agreement.”

Source