Ugandan athlete Rebecca Cheptegei die afta fire attack by boyfirend

Ugandan athlete Rebecca Cheptegei don die, Uganda Athletics Federation confam.

Di athlete wey base for Kenya die from severe injuries wey she suffer afta her boyfriend put fire for her body.

Di federation for dia post on X say dem dey call for justice over di death of dia athlete.

“We dey deeply saddened to announce di passing of our athlete, Rebecca Cheptegei early dis morning wey tragically become victim to domestic violence.”

“As a federation, we condemn such acts and call for justice. May her soul rest In Peace.

Di attack happun on Sunday and she don dey critical condition since den. Di burns na for over 75% of her body afta her boyfriend allegedly attack her.

Di fire also burn Dickson Ndiema Marangach, wey authorities identify as di boyfriend.

Tori be say di boyfriend of di athlete allegedly pour her fuel during argument wey dem dey get. Na neighbours rescue Cheptegei afta di attack wey happun for di small town of Endebess.

One local administrator for di report wey im file say di two bin dey fight over di land.

Police say dem dey torchlight di attack.

Cheptegei, na promising athlete wey popular well-well for Uganda sports community.

Cheptegei wey come from a region just across di border fofr Uganda, bin buy land for Trans Nzoia county and build house – di place dey near Kenya many athletic training centres.

Di 33-year-old Cheptegei, wey finish 44th for Paris get house for Kenya wia she dey live and train.

She also win gold for di World Mountain and Trail Running Championships in Chiang Mai, Thailand, in 2022.

In April 2022, dem find anoda female runner, Damaris Mutua strangled inside house wit pillow on top her face for di Rift Valley town of Iten.

E happun came months afta dem find record-breaking long-distance runner Agnes Tirop stabbed to death for di same town.

Men don also become target of attacks.

Last December, some pipo stab Ugandan athlete, Benjamin Kiplagat to death for Eldoret.

Source