Police fire protesters as Kenya lawmakers pass controversial finance bill

Kenyans dey protest one finance tax bill wey MPs dey try pass

BBC

Dem don shoot four protesters outside parliament, one NGO, di Kenya Human Rights Commission, tok.

Di group say one pesin don die. Oda sources neva confam di death yet.

“Such actions dey unacceptable and make up to serious violation of human rights,” dem add.

Video show as protesters dey push enter parliament wia MPs just vote to approve di controversial finance bill, wey go raise some tax.

Hundreds of protesters now don enter di complex wia parliament dey sit, live TV fotos show am.

Thick clouds of tear gas don take over di parliament as police try to push dem out.

Until some minutes ago, MPs bin dey debate di controversial finance bill bifor dem pass am.

Kenyan police bin earlier fire tear gas and rubber bullets to scata protesters for di capital, Nairobi, as di anti-tax demonstrations across di kontri continue.

Businesses shut down and transportation don dey paralysed for di city, with police wey dey face di demonstrators.

Di protests wey di youths dey lead bin dey call on MPs to reject proposed tax increases.

Government, wey don row back on some of di most controversial measures, say new taxes dey needed to fund spending programmes and lessen di debt burden.

Protester hold flag and demonstrate

Reuters

Crowds bin also gada for many oda parts of di kontri, with local Kenya newspaper the Daily Nation reporting protests in about 30 of di kontri 47 counties.

Lawyers and human rights groups bin don express concern about anyhow arrests and di intimidation of activists during earlier protests.

E come as reports say at least five prominent social media users don dey abducted early mor-mor, hours before di demonstrations.

Government don defend di taxes as necessary for raising additional revenue to reduce Kenya significant debt, but last week dem accept some demands.

Dem scrap some controversial taxes including proposed taxes on bread, cooking oil and motor vehicle ownership as pipo protest.

But di protesters say e no dey enough, and dey call for di complete withdrawal of di bill.

Despite dat, majority MPs pass di controversial bill during im second reading and on Tuesday dem dey debate di various amendments, to remove some of di clauses wey di government see say get issues.

Protesters enta street for Kenya to do I no go gree against tax increase

BBC

More fotos from di protest on Tuesday

Kenya protest

BBC
Protesters enta street for Kenya to do I no go gree ag

BBC
Protesters enta street for Kenya to do I no go gree ag

BBC
One protester pour water for im mate head for di Kenya waka against tax increase

BBC
One protester pour water for im mate head for di Kenya waka against tax increase

Source