France vs Poland, Netherlands vs Austria Euro 2024 final group D clash

Mbappe and Lewandowski

Getty Images
France dey hope to top dia group wit win vs Poland wey already dey eliminated

France dey prepare to take on Poland wey don already comot di Euros wit two defeats from dia first two games.

Les Bleus currently dey second wit four points, same as Netherlands.

Di final round of games for dis group go see who go top di group as dem progress to round of 16.

For dia last game, France and Netherlands play goalless draw as Austria defeat Poland 3-1.

But for dis game between France and Poland, coach Didier Deschamps say im no dey take tins lightly.

“For World Cup in Doha, I rest players for di final group game sake of we already don get di spot. But dis time, tins dey different wia we neva know if we go finish as top or not,” di French coach tok for pre-match press conference.

Di talking point bifor di game against Netherlands na whether captain Kylian Mbappe go play afta im sustain nose injury for dia first game.

Di Real Madrid forward no play any minute for dat game but today, im go enta di starting line-up, im coach don hint.

“Di swelling for Mbappe im nose don go down and di player dey prepared to play.”

Many French fans go expect dia captain to start dis game wit im protective face mask.

Midfielder Ngolo Kanté wey carry man-of-di-match awards for dia first two games, tok say im dey impressed about Mbappe for training, despite im nose injury.

“Kylian dey decisive and dangerous for training, I even forget say im dey wear face mask, wia im score goals. I hope say dat form go translate for di game vs Poland,” di Al Ittihad midfielder tok.

For Poland, even tho dem exit di tournament, dem say dem go fight for di points vs France.

Captain Robert Lewandowski say im dey look forward to dat game wia e no go be di last time im go play for Poland despite say im dey 36 years.

“I hope say we go play our best game for di tournament vs France – even though we don dey play for pride,” di Barcelona striker tok.

France v Poland team news

France Coach Didier Deschamps tok say all im players dey available for selection.

Real Madrid midfielder Aurelien Tchouameni wey recover from foot injury don play for dia game against Netherlands.

Deschamps dey likely to involve di kontri record goal scorer Olivier Giroud for dis game as Marcus Thuram wey play vs Netherlands no deliver.

So im too dey available.

Poland coach Michal Probierz get all im squad available except defender Bartosz Salamon afta im miss dia game wit Austria due to ankle injury.

Head-to-head

Poland neva beat France for dia last 8 games wey include friendly games.

Poland don lose 4 wia dem draw 4 of those games.

Di last time Poland beat France for competitive match na during di 1982 World Cup third-place playoff.

But overall, France and Poland face each oda 17 times – Les Bleus win 9, Poland win 3 wit 5 draws.

From those 17 games, France score 30 goals wia Poland score 17.

Probable lineups

France XI: Maignan (GK); Kounde, Upamecano, Konate, Hernandez, Tchouameni, Camavinga, Rabiot, Griezmann, Mbappe, Giroud

Poland XI: Szczesny (GK); Bednarek, Dawidowicz, Kiwior, Frankowski, Zielinski, Slisz, Piotriwski, Buksa, Piatek, Lewandowski

Di match dey happun for di Signal Iduna park at 5PM WAT.

At di same time, Netherlands go dey play wit Austria.

Source