Dis na di second largest diamond for di world wey dem discover for Africa

Dem don see di second-largest ever diamond for di world for Botswana.

One Canadian firm, Lucara Diamond bin unearth di 2,492-carat stone from dia mine for Botswana.

Na di biggest diamond dem go ever find since di 3,106-carat Cullinan diamond, dem discover for South Africa for 1905.

Dem bin cut am into nine separate stones, and many of dem dey for di British Crown Jewels.

Dem discover di diamond for Karowe mine, wey dey about 500km (300 miles) north of Botswana capital, Gaborone.

Botswana government tok say na di largest diamond dem go ever discover for di southern African state.

Di previous biggest discovery for Botswana na one 1,758-carat stone dem see for di same mine for 2019.

Botswana na one of di world biggest producer of diamonds, dem account for about 20% of global production.

Wetin to know about di diamond

For one statement, Lucara say di stone na “one of di largest rough diamonds ever unearthed”.

“We dey very happy about di recovery of dis extraordinary 2,492 carat diamond,” Lucara boss, William Lamb tok.

Di firm no give details about di gem quality or im value.

Na Lucara Mega Diamond Recovery X-ray technology dem use detect di diamond, Oga Lamb tok.

Di organisation don dey use am since 2017 to detect and preserve high-value diamonds so dat dem no go break during ore-crushing processes, according to di Miningmx publication.

Lucara get 100% ownership of di mine for Karowe.

Botswana government don propose one law wey go ask companies dem grant license to mine, to sell 24% stake give local firms if di government no exercise di option say dem wan become shareholder, Reuters news agency bin report for July, 2024.

Source